Senator Nwoko vs Okowa, Daniel wey Govnor Abiodun dey challenge withdraw from APC Senate primaries - who and who dey contest

Wia dis foto come from, Hope Uzodinma/Rochas Okorocha/Ifeanyi Okowa/Ned Nwoko/Gbenga Daniel/Dapo Abiodun/Facebook
Several serving govnors wey dia tenure go soon end and former govnors dey among di aspirants wey dey chook head for di Senate primary elections of di ruling All Progressives Congress (APC) wey dey happun today.
Although, APC neva release di list of aspirants wey dem don screen and dem also neva release list of aspirants wey dey cleared to contest for di primaries or dose wey no dey cleared.
Inside APC guideline for di primaries, na indirect primary election go happun if di aspirants no fit agree on consensus candidate.
However, while some senatorial districts dey contest unopposed, some go face strong opponent for di Senate primaries.
Some of di serving govnors wey dey contest for APC senatorial tickets include Govnor Hope Uzodimma for Imo West Senatorial District, Govnor Ahmadu Fintiri of Adamawa North, Govnor Abdullahi Sule for Nasarawa North, Govnor Dapo Abiodun for Ogun East.
Meanwhile, current Senate President Godswill Akpabio wey dey represent Akwa-Ibom Northwest senatorial district, current deputy Senate President Barau Jibrin for Kano North and Senate Leader Opeyemi Bamidele wey dey represent Ekiti Central, be like say dem no get any opposition for dia own senatorial district.
Who dey head to head for APC Senate primaries?
Imo State
Current govnor of Imo State Hope Uzodimma, wey be say im second term go end for January 2028, don collect form for di Imo West senatorial district to battle former govnor.
Former Imo govnor wey don dey di senate bifor, Senator Rochas Okorocha dey put head for di primaries.
Report say incumbent Senator wey dey represent di district, Osita Izunaso withdraw from di contest. But e neva clear weda im name go dey among dose wey go participate for di primaries.
Senator Osita Izunaso represent Imo West from 2007 to 2011 and later return for 2023 to serve again.
Uzodimma don represent Imo West as senator bifor from 2011 to 2019 bifor e later contest for govnorship election.
Meanwhile, Rochas Okorocha, former govnor of di state from 2013 to 2018 later enta senate for 2019 to 2023 to represent di Imo West senatorial zone.
Dis giant pipo for Imo politics go battle am out for di ticket.
Uzodinma say na di pipo of Imo West Senatorial District call am to serve again for di senate, even though im tenure neva end.
Delta State
For Delta North, dis race go tight between incumbent Senator Ned Nwoko and Senator Ifeanyi Okowa, wey be former govnor of Delta State.
Di battle for dis ticket go long as Nwoko dey seek second term for office afta e enta office under Peoples Democratic Party (PDP).
Meanwhile, Okowa also come from PDP to APC and e dey seek to return to di senate afta e comot for dia about eleven years ago.
Ogun State
Dis senatorial race for Ogun State na strong one as two bih names dey go head to head.
Former govnor Gbenga Daniel wey don dey di senate to represent Ogun East dey face outgoing govnor Dapo Abiodun.
Gbenga Daniel pick im nomination and expression of interest forms return to di Nigerian Senate, but im opponent Abiodun chook head.
Di political tension in Ogun state is raising serious concern and both camps tanda wit each oda.
Although Dapo Abiodun say APC don endorse am as consensus candidate for di 2027 Ogun East Senatorial election.
Early Monday morning, report say Gbenga Daniel dey withdraw from di race ontop accusations of threat.
E say im withdraw from di APC primaries sake of political violence wey im supporters dey face in recent weeks.
Kano State
Be like former Kano State govnor Ibrahim Shekarau go contest unopposed for di Kano Central District ticket. But di list go determine who dey ballot.
Edo State
For Edo North Senatorial district, e appear say former govnor Adams Oshiomhole no get opposition.
Odas include, AbdulRahman AbdulRazaq for Kwara Central), Muhammad Inuwa Yahaya for Gombe North), Majority Whip Mohammed Tahir Monguno for Borno Nort), Mai Mala Buni for Yobe South.










