DR Congo frustrate Portugal wit dia first ever World Cup goal

Wia dis foto come from, Getty Images
DR Congo hold Group K favourites to 1-1 draw for di 2026 Fifa World Cup.
Joao Neves score di goal for Portugal for di sixth minute bifor Yoane Wissa score DR Congo equaliser for di last minute of di first half. Dis na DR Congo first ever goal for World Cup.
Portugal and DR Congo create beta chances to score more goals but dem no fit convert dem.
Portugal top player Cristiano Ronaldo play full time but DR Congo defenders no let am see road well to score.
DR Congo from dis match show say dem no go World Cup to play.
Second Half
Full Time Portugal 1-1 DR Congo
Match don end
90+5 Last chance for di match for players to attack but dimatch don end.
90+3 DR Congo dey defend wit dia life and e don dey put Portugal under pressure as na dfew minutes of added time remain.
90' Referee add 5 minutes
89' Nelson Senendo of Portugal don collect Yellow card for foul against DR Congo player.
84' DR Congo dey give Portugal tough time for dis game as na only few minutes remain for regulation time to end.
80' DR Congo get freekick but no goal so far from all di setpieces wey dem don get.
77' Bakambu of DR Congoplay di ball to di side bar of di goal post afta beta buildup to goal, e waste di chance.
73' Ronaldo of Portugal get anoda chance but defenders no dey let am see road.
69' Cristiano Ronaldo miss goal opportunity as di ball land for side net.
67' Portugal get freekick afta Wissa foul im opponent.
63' Wissa of DR Congo pass di ball give Bakambu wey fire shot toward goal but Portugal goalkeeper catch di ball.
59' Corner kick for Portugal, Concealo play am but DR Congo player head di ball out of di goal area.
57' Bakambu of DR Congo fire beta shot wey hide di side bar of di goalpost.
55' Portugal play ball enta net but linesman say na offside so no be goal.
54' Be like say Cristiano Ronaldo of Portugal no wan score o, e just dey pass di ball to im teammates wey go later lose di ball.
50' Bakambu of DR Congo fire beat shot for Portugal goal area, but goalkeeper save di shot bifor referee say Bakumbu dey offside.
48' DR Congo finally collect di ball dem string few passes and lose di ball again, Goal kick for Portugal.
47' Portugal still dey hold di ball since second half start.
46' Second half don start

Wia dis foto come from, Stacy Revere - FIFA/ Carmen Mandato - FIFA via Getty Images
First Half
Half Time
Portugal 1-1 DR Congo
45+6 Referee blow whistle first half don end.
45+5 Yoane Wissa score DR Congo first World Cup goal afta Masuaku cross di ball to Wissa wey head di ball inside net
45+5 GOALLLLLLLL FOR DR CONGO
45+3 Corner kick for DR Congo, dem play am but e enta corner kick again, dem pass am and e turn to
45' Referee add 4 minutes
42' Portugal dey hustle to score dia second goal but DR Congo defence nondey give dem chance.
38' DR Congo tiff ball from Porugal player leg , from dia goal area DR Congo player do counter attack but e no dey successful.
36' Portugal no dey allow DR Congo play ball ans DR Congo too no dey give Cristiano Ronald space.
34' Yoane Wissa of DR Congo fire shot from outside di box but e land for Portugal goalkeeper hand.
33' Chancel Mbemba of DR Congo don collect Yellow card sake of foul on Portugal player.
30' DR Congo get chance around Portugal goal area but no space as Portugal defenders block evriwia, e no tey DR Congo lose di ball to Portugal wey clear di ball far out.
27' Corner kick for Portugal, dem pass am to build but Porugal still dey DR Congo goal area.
21' Portugal just dey control di game from evri corner as DR Congo wey don get half chance for di match so far no fit convert anyone.
18' Bruno Fernandes miss beta chance to score for Portugal as DR Congo defend block one and DR Congo goalkeeper punch one out.
16' Cristiano Ronaldo carry ball enta DR Conga area e pass di ball give im teammate wey play di ball give dia opponent.
14' Corner for DR COngo but notin come out, dem still hold di ball but e later go out of play.
11' DR Congo player Yoane Wissa make attempt near goal but im dey too far from di goal area wen e plat shot, di ball roll go di left corner of di goalpost.
9' Portugal dey dominate di game so far, DR Congo neva see beta chance to even hold ball well.
Portugal 1-0 DR Congo
6' Joao Neves head di ball inside net afta beta cross Pedro Neto
6' GOALLLLLL FOR PORTUGAL!! Joao Neves score for Portugal.
4' Cristiano Ronaldo of Portugal hold di ball for DR Congo goal area but space no dey, im pass di ball give im teammate.
3' Portugal dey hold ball since referee start dis match.
1' Match don start

Wia dis foto come from, Leonardo Fernandez / Stringer via Getty Images
Portugal starting XI
Costa; Dalot, Dias, Veiga, Mendes; Vitinha, Neves, Fernandes; Conceicao, Cristiano Ronaldo, Leao.
DR Congo starting XI
Mpasi-Nzau; Wan-Bissaka, Mbemba, Tuanzebe, Masuaku; Sadiki, Moutoussamy; Mbuku, Yoane Wissa, Elia; Bakambu.

Wia dis foto come from, RONALDO SCHEMIDT VIA GETTY IMAGES
Di Congolese squad spend long time for training camp for Europe bicos of di Ebola outbreak for dia kontri. Dem play friendly matches against Denmark and Chile bifor dem arrive Houston, wia dem still dey adjust to di hot and humid weather.
But di delay don also give dem chance to watch di first 20 matches of di tournament and understand di level of competition bifor dia return to di World Cup, 52 years afta dia only appearance as Zaire for 1974.
DR Congo go also face Cristiano Ronaldo, one player wey Wissa sabi well from Premier League days wen Ronaldo bin dey for Manchester United and Wissa dey play for Brentford.
Morocco, Ivory Coast, Egypt and Cape Verde don already make strong starts for di World Cup, and Wissa hope say DR Congo go continue di good performance of African teams.









