'Dis no be easy decision' - Mahmoud Sadis Buba withdraw from 2027 general elections race

Published
Read am in 4 mins

Mahmoud Sadis Buba alias "Abin Al'ajabi" (The wonder), wey recently enta public eye sake of im decision to contest for di 2027 election don withdraw from di race.

For one post on im Facebook account on Saturday, 16 May, Buba announce im withdrawal from di race for Sabon Gari Federal Constituency, House of Representatives, effective immediately, for inside one letter e address to di Chairman of im party, di All Progressives Congress (APC) for Kaduna state.

E say di reason for im withdrawal na "in di interest of di APC".

"Dis no be easy decision. But na sake of di reconciliation efforts wey di stakeholders and leaders of our party initiate. Afta long consultations wit my family, political associates, and stakeholders within our great party, I don decide say decision na in di best interest of di All Progressives Congress (APC). I believe say to stand gidigba for di back of one single candidate dey important to our victory for di general election and for di ontinued progress of our constituency and state," e tok for di statement.

Di young politician from Kaduna State bin draw public attention afta e pass screening stage of All Progressives Congress (APC) for House of Representatives seat for Sabon Gari, Zaria.

Wetin bin make am go viral na sake of im small stature and controversy ova im age.

Allegations dey say e fake im age, say e no reach di age wey e dey claim. Different documents dey spread on social media, although nobody don officially sue am.

However for one interview wit BBC bifor e withdraw from di race, Buba bin claim say im bin 25, and e qualify for di position since im don pass di constitutional age.

E also tok say im small bodi size, wey e inherit from im papa side grandpapa, no go affect im ability to serve for National Assembly.

According to am, na pipo from im constituency encourage am make e run becos of di work wey e dey do for di community.

"Na so God create me, and na so e want make I be. My condition never worry me; instead na sometin wey I dey proud of."

E add say some of di challenges wey e dey face na how some pipo dey mock im bodi.

"Some pipo, if dem no like you, dem go say, 'see as e short, e no get height.''

E tell BBC say e be former driver and now na chairman of support group for Bola Tinubu and Uba Sani for 2027.

"I don dey inside politics since long time, even from Buhari time. Now, anytime I fit go see di president."

Who be Mahmoud Sadis Buba?

Mahmoud Sadis Buba dem born am for Zaria local govment for Kaduna.

And according to am, e be 30 years old. For inside one viral video during im screening, e tok say e be 30, though im body size make many pipo dey doubt am.

E come from Sabon Gari constituency for Zaria, Kaduna State, and na di first pikin among nine children.

E get dwarfism, wey e say e inherit from im grandfather for im papa side.

According to am, all im family dey stay for Zaria Local Govment Area of Kaduna State. E still dey take care of about 20 relatives and orphans for im house for Zaria.

Abin Al'ajabi say e be businessman bicos e get shops and motorcycles wey e dey give pipo for hire for im hometown.

Mahmoud Sadis Buba, wey dem also sabi as "Al-ajabin Zazzau," don collect im Expression of Interest and Nomination Forms to contest for House of Representatives seat wey represent Sabon Gari Federal Constituency for Kaduna State under APC.