Netanyahu say pilot chop arrest afta e stab co-pilot and try to crash plane wey dey go Israel

Wia dis foto come from, John Lamparski/Bloomberg via Getty, JACK GUEZ/AFP via Getty Images
One pilot for one Israel-bound plane stab im co-pilot and "apparently try to crash di plane", Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu tok.
Di plane bin dey travel from Dubai to Tel Aviv wen e drop from 17,000ft (5,200m) in less dan two minutes, bifor dem divert am to Saudi Arabia.
One passenger report "terrible screams throughout di plane" bifor "three to five guys burst into di cockpit" and overpower di attacker
Anoda passenger say "we take control of di flight" from "one assailant wit a knife" - meanwhile, two oda pilots, wey sit for back, reportedly come forward to land di plane
Netanyahu say di pilot wey launch di attack don chop arrest. E "salute di heroes" wey "saved many lives and prevent major disaster"
Di Flydubai plane wey take off from Dubai International Airport early on Wednesday send emergency code about two hours afta di journey start, according to flight tracking website Flightradar24.
Few minutes later, di plane switch to code wey dem dey use report hijacking, but later return back to di general emergency signal.
Dem believe say di emergency signal come afta one "altercation" between di pilot and co-pilot, according to local media reports wey quote Israeli defence officials.

Wia dis foto come from, BBC/FlightRadar
Weti happun inside di FlyDubai flight
Flight FZ1073 - wey carry about 150 pipo, most of dem Israelis bin suppose land for Ben-Gurion Airport but instead land for Tabuk Airport for northeastern Saudi Arabia.
Reports say di alarm happun afta one 'fight' between di pilot and di co-pilot.
One Israeli passenger wey dey onboard tell journalists say di crew ask for help and passengers later help overpower one of di pilots and tie am down.
For one statement, lsraeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say di situation don dey under control and efforts dey ongoing to return di Israeli passengers from Saudi Arabia back home.
Flydubai confam say di flight "experience one incident" but say "all passengers safe and accounted for".
"Flydubai fit confam say flight FZ1073 wey dey operate from Dubai International (DXB) go Ben Gurion International Airport (TLV) on 30 September experience one incident while e dey on route," di statement tok.
"Di aircraft land safely for Tabuk Airport (TUU) and all passengers safe and accounted for. Di safety and well- being of our passengers and crew remain our highest priority.

Wia dis foto come from, FLIGHTRADAR24/REUTERS
"Our teams dey work closely wit di relevant authorities. We go provide further updates as more confirmed details bicom available."
Yasmin Abu Kasis tell di news agency say im daughter Miriam bin dey onboard di flight and say she hear pipo dey scream.
Im daughter say one man wey hold knife force one of di pilots enter floor, and say blood dey evri wia.
One lsraeli passenger wey dey onboard tell journalists say di crew ask for help, and say passengers help overpower one of di pilots and tie am down.
Di Flydubai plane wey take off early on Wednesday bin send emergency code two hours afta di flight start, according to tracking website Flightradar24.
More reports dey come from Israeli media about wetin really happun for di Dubai to Tel Aviv flight.
One passenger wey no mention im name tell di Jerusalem Post say one pilot stab anoda pilot, but passengers wey sit near di front of di plane help force di attacker comot from di cockpit.
Di witness say two oda pilots bin dey onboard, for di back of di plane.
shout at dem make dem run go take control of di plane," di passenger tell di Jerusalem Post.
Di passenger also say one dentist wey dey onboard di flight give di injured pilot life-saving treatment.
'Blood evriwia': Passengers describe fear on board
Passengers wey dey on board di flight dey tok to various media outlets. BBC News neva dey able to verify dia accounts.
Yasmin Abukasis tell Reuters say her daughter - wey dey in di flight say one man hold knife force one of di pilots to di floor, and say bl;ood dey evriwia.
E add two oda pilots take control of di plane as oda passengers run towards man wey hold di knife.
"Di plane start to lose control. So all di pipo, begin dey scream, dem tink say dem don go," Abukasis tell AP news agency.
One female passenger describe di "very stressful" moment pipo realise say di plane dey descend. "We understand say di pilots lose control," she tell Israeli newspaper Israel Hayom.
"E get pipo here wit shirts wey dey covered in blood. Now we are fine and want to return home." she say.



















