Timeline of attacks for Nigeria as gunmen kidnap pipo for Kwara State and burn Emir palace

One man hold gun

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Published
Read am in 5 mins

Suspected armed bandits kidnap ten pipo for Yashikira community, Baruten Local Govment Area of Kwara State for di early hours of Monday, 25 May go unknown destination.

Di state police command wey confam di incident tok say di bandits also attack di Yashikira Police Divisional Headquarters plus di Palace of di Emir of Yashikira. Dem burn some part of di palace during di attack.

Di police describe di attack wey happun around 2:00 GMT for di north-central state as "coordinated and desperate assault".

Kwara State Commissioner of Police Ojo Adekimi say im don order full-scale, intelligence-driven tactical operation wey involve di Police, Military, Forest Guards, Vigilantes, and oda security stakeholders to search di surrounding forests and criminal hideouts, to find and rescue di victims.

"We go deploy evritin within our operational capacity to smoke dem out of hiding, dismantle dia networks, rescue all abducted victims, and ensure say dem face di full wrath of di law," di CP tok for statement.

However, earlier accounts from residents tok say di attackers storm di community between about 12:00 and 2:00 GMT, dem fire gunshots sporadically bifor dem march go di palace and surrounding areas.

Reports say di attackers bin operate for hours witout resistance, and dem leave behind destruction and fear for di border community.

Timeline of attacks wey don happun since di Oyo attack

Kwara State church attack

Dis latest attack for Kwara State dey come afta armed bandits on Saturday night attack one prayer ground for Ori-Oke Ajaiye, wey dey di outskirts of Ikiran village for Ekiti Local Govment Area of Kwara State.

Di state police command wey confam di attack, tok say na one Pastor Adebayo Abiodun report di incident on Sunday by 10:30pm.

Di pastor say while while dem dey do night vigil on Saturday, 23 May around 10:30pm, armed hoodlums invade di prayer ground, fire guns wey kpai three pipo, and dem abduct fifteen odas to unknown destination.

Di police commissioner describe di attack as "barbaric, callous and unacceptable," as e assure families of di victims say di command go rescue di abducted worshippers and bring dose wey dey responsible to justice.

Oyo schools attack

Dis attack also dey come as di kontri still dey mourn di death of one mathematics teacher, wey gunmen kpai.

Di teacher bin dey among di seven oda teachers and schoolchildren wey di gunmen kidnap from one school for Oriire Local Govment Area of Oyo State.

On 15 May, around 8:00 and 9:00 GMT, gunmen attack three schools across Esinele community for Oriire Local Govment Area of Oyo State.

Tori be say di terrorists ride motorcycle into di community to kidnap schoolchildren and teachers from Community High School, Ahoro-Esinele, and Yawota Baptist schools.

Di gunmen kill one teacher during di attack, kidnap di school principal, and kidnap schoolchildren from Community High School.

Di Oyo State Police tok-tok pesin, Ayanlade Olayinka wey confam di attack tok say di students bin dey perform song wen di gunmen attack di school and dem begin dey shoot.

Days afta, video of how di kidnappers take kpai one of di teachers bin go viral.

Di death of di teacher don generate plenty reactions from citizens on security for di kontri.

President Bola Tinubu, di Oyo state Govnor Seyi Makinde plus oda top politicians don condemn di attack.

For inside one statement by di presidency, di president tok say security operatives go rescue all di remaining victims while e charge di national assembly make dem do quick enact di law for di creation of state police.

Di president also condemn di death of di teacher wey di gunmen kill.

Despite di strong reactions from govment, di kidnapped victims neva regain freedom.

However, according to reports, di gunmen don open communication wit di Oyo State govment.

Informate neva dey clear on di details of di communication, wetin be dia demands, or who exactly dem dey follow tok for govment.

Borno school attack

Di same Friday wey di Oyo attack happun, gunmen bin kidnap more dan 50 children from Mussa Central Primary Schools for Askira-Uba Local Govment Area, southern Borno, northern Nigeria.

Parents of di schoolchildren wey give update of di attack on Saturday, 16 May, tok say most of di victims na children from di nursery section of di schools wey dem believe say dey between two and five years old.

Most of di children dey between two and five years old.

Eyewitnesses say di suspects use di children as human shields as dem dey run on motorbikes, wey stop security forces from opening fire.

Police for Borno State wey confam di incident say armed men attack one primary school and one secondary school for Mussa village for morning.

Police tok-tok pesin Nahum Daso tell di BBC say di attackers arrive at about 09:00 local time.

Authorities suspect say di gunmen na fighters from either Boko Haram or dia rival faction, di Islamic State West Africa Province (Iswap) - both of dem dey active for di region.

No group don claim responsibility for di attacks.

Some reports suggest say di attacks bear di hallmark of Boko Haram - di Islamist group wey wan take control of di region against dia rival faction, Islamic State West Africa Province (Iswap).

72 hours afta di abduction, authorities for di state say dem don deploy local vigilantes alongside security forces to track down kidnappers wey abduct di children.

Di Chairman of Askira Uba Local Govment Area tell parents say di vigilante group go work wit sojas to follow di trail of di kidnappers.

Weeks afta di incident, di whereabouts of di children still neva dey known.

Borno State na di centre of Nigeria Islamist insurgency for nearly two decades, as armed groups don repeatedly target schools, villages and civilians across di region.

Ova 40,000 don die and more dan two million odas dey displaced.