Wetin di change of army leadership mean for insecurity for Nigeria

Nigeria army personnel

Wia dis foto come from, SODIQ ADELAKUN/AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Di Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, don approve di redeployment of senior staff dem to go key command, operational and staff appointments though out di Nigerian army.

According to statement wey di acting Army Director for Public Relations, Colonel Appolonia Anele bring come outside di move na part of di army efforts to "increase perational effectiveness, strengthen leadership and join di service command structure wit Nigeria im ever changing security environment".

Dem add say dem focus di leadership change for theatres wey still dey operational.

Dis dey come afta di United states announce say dem dey comot about 200 military personnel from Nigeria by di end of September.

According to di statement, di exercise na to "make sure say di right leadership, experience and expertise dey in di position to deliver beta effects".

Di last time wey di military bin change leadership for id army na for June hia.

Dat time dem say na so dem go fit "strengthen national security and ginger so dem go fit ansa security challenges across di kontir."

Dat time dem announce say di new appointments dem bin affect field commanders, school commandants and principal staff officers for di Army Headquarters.

Di appointments bin no change pipo from wia dem dey but bin focus on operational leaderships of Brigades and one command for di Headquaters.

Dem bin also make appointments for professional military education and institutional development and leadership for military and housing mata.

Wetin be di new reshuffle wey di Nigerian army make

Most of di appointments bin move leaders around di force. For di new postings,

  • Major General IA Ajose comot Army Headquarters (AHQ), Department of Army Operations go Theatre Command Joint Task Force (JTF) North East, Operation HADIN KAI (OPHK), as Theatre Commande
  • Major General AE Abubakar comot Operation HADIN KAI (OPHK) go di Nigerian Army Heritage and Future Centre (NAHFC) as Dean, Faculty of Operational Research.
  • Major General AM Alechenu comot Defence Headquarters (DHQ) Garrison go di Nigerian Army Heritage and Future Centre
  • Major General RT Utsaha comot AHQ Department of Army Standards and Evaluation go DHQ Garrison as Commander.
  • Major General AM Umar comot AHQ Department of Civil-Military Affairs (DCMA) go Army War College Nigeria (AWCN) as Commandant
  • Major General UM Alkali comot AWCN go AHQ DCMA
  • Major General GS Muhammed comot di Office of the National Security Adviser (ONSA) go di Nigerian Army Finance Corporation (NAFIC) as Director General
  • Major General JE Osifo comot NAFIC go di Military Pension Board (MPB) as Chairman
  • Major General IE Ekpenyong don move go DHQ Department of Defence Logistics as Director Engineering Services.
  • Brigadier General AA Bello comot 6 Division Garrison/Sector 3 JTF South-South, Operation DELTA SAFE go DHQ Department of Defence Operations
  • Brigadier General MS Adamu don move from Nigerian Army Women Command go di new 8 Brigade as Commander
  • Brigadier General MS Sul comot Special Task Force Operation ENDURING PEACE go 27 Task Force Brigade as Commander.
  • Brigadier General I Sule comot di Directorate of Recruitment Management go 6 Division Garrison as Commander
  • Brigadier General E Azenda comot Land Forces Simulation Centre go 2 Division Garrison as Commander
  • Brigadier General AS Bugaje comot 2 Division Garrison go di Land Forces Simulation Centre as Director Administration.

How e go help wit national securty

Dis posting na part of di biggest expansion of di military wey Nigeria don see.

For July Bola Tinubu bin press go on di creation of four new army division and also add 28,000 extra soldiers in response to di kasala wey don dey di kontri dis year.

Sabi pesin for security, Awwal Abdullahi Aliyu tell BBC say, "You see, wen dem recruit dis soldiers, evri Battalion go get enof personnel. Dis one go expand military operations and ensure say areas wey before no get military presence go now get soldiers."

Di expert tok say, "I believe say dis fit reduce di security wahala by 75 percent."

Tinubu tok say di expansion na to demonstrate im administration commitment to continue investing for di Nigeria security infrastructure in terms of improvement for military hardware and equipment, beta welfare for di troops, and modernisation of di entire armed forces.

Dis efforts, according to di presidency, go help Nigeria to beta tackle di plenty security challenges wey dey face di kontri, and also make di military eva ready to defend Nigeria from internal and external aggression.