Creation of four new Army Divisions fit change Nigeria fight against terrorism?

Wia dis foto come from, Getty Images
President Bola Tinubu don approve make Nigerian Army expand from eight Divisions to 12 divisions.
Di president say dis na as part of effort to strengthen di kontri security structure and improve how di military dey carry out dia operations.
Di approval also include recruitment of 28,000 additional personnel to increase di Army capacity to tackle Nigeria security challenges.
According to statement wey Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga release, di expansion na part of di administration continuous investment for di Armed Forces.
E include to buy more of military equipment, improvement for troops welfare, and support for operational readiness and force modernisation.
How di new structure go be
Under di new structure, Nigerian Army go operate 12 Divisions wey dey spread across di kontri.
Di division headquarters go dey Kaduna, Ibadan, Jos, Makurdi, Port Harcourt, Maiduguri, Sokoto, Ilorin, Jalingo, Lagos, Enugu and Benin City, wit each division responsible for designated states.
Di Presidency tok say di establishment of new divisions for Makurdi, Ilorin, Jalingo and Benin City go improve command and control, decentralise operational decision-making and strengthen border security.
Dem say e go also improve protection of critical national infrastructure, improve counter-insurgency and internal security operations, and ensure faster military response to emerging security threats across di kontri.
Dem go implement di new force structure for two phases. Di first phase, wey include establishment of di 5, 9 and 10 Divisions plus reorganisation of existing formations, expected to finish by September 2026.
Di second phase, wey involve establishment of di 83 Division and further reorganisation, scheduled to finish by December 2026.
Under di new structure, Nigerian Army go operate 12 divisions wey dey spread across di kontri.
Di division headquarters go dey Kaduna, Ibadan, Jos, Makurdi, Port Harcourt, Maiduguri, Sokoto, Ilorin, Jalingo, Lagos, Enugu and Benin City, wit each division responsible for designated states.
Creation of four new Army Divisions fit change any tin?
For interview wit BBC, security expert Awwal Abdullahi Aliyu, tok say di Nigerian government decision to create four additional army divisions on top di existing ones go help for di fight against Boko Haram, ISWAP and bandits.
Aliyu wey be di Deputy National Coordinator of di Retired Members of di Nigerian Armed Forces, say "Dis decision mean say di number of soldiers go increase. E also mean say dem go recruit new soldiers, and we don hear say dem go recruit 28,000 new soldiers."
E add say "You see, wen dem recruit dis soldiers, evri Battalion go get enof personnel. Dis one go expand military operations and ensure say areas wey before no get military presence go now get soldiers."
E add say di move go help stop criminals from carrying out attacks.
"Now, areas wey no get enof sojas go get dem, and places wey bifor no get soldiers go now get dem. Dis one go also improve connectivity among di troops and prevent terrorists from carrying out dia activities," e tok.
Di expert tok say, "I believe say dis fit reduce di security wahala by 75 percent."
On di oda hand, Dr. Aliyu tok say e no tink say operational challenges go dey, but challenges from di govment side.
"Di biggest challenge go be funding sake sau govment gatz build facilities and provide equipment. If you look am well, dis go require plenty money."
Boko Haram, ISWAP dey recruit children - Bwala
For related development, Special Adviser to President Bola Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, tok say Boko Haram dey replenish dia ranks by abducting children from villages anytime di terrorist group suffer major losses.
Bwala make dis statement on Wednesday while e dey speak for Channels Television Politics Today.
"When Boko Haram start to lose dia members, dem dey go villages carry children go bush and recruit dem; na dis pipo dem recruit against dia will," Bwala tok.
Dis na one of di issues many Nigerians believe dey slow down di fight against Boko Haram and ISWAP for Lake Chad region.
However, security expert Dr. Kabiru Adamu, di Chief Executive of Beacon Security, also confirm to BBC say dis na one of di methods terrorists dey use recruit children into dia groups.
"Our research don show us say terrorists dey recruit children so dem fit replace dem for future. But dat no be di only reason wey make dis groups dey abduct children."
E add, "Anoda reason be say na to use di children for activities inside dia camps. Dem also dey use dem for prisoner exchanges, for example, to pressure govment make e take actions wey e no wan take.
"But bicos na children, and bicos of di importance of children, govment sometimes dey forced to take decisions wey e for no take."
Dr. Adamu also tok say di terrorists dey use di children collect ransom payments.
However, e warn say dis fit create wahala for future.
"Children na di foundation of evri society. Any society wey allow di upbringing of im children spoil likely go see im future development affected."
Di expert call on Nigeria, as a kontri, to intensify efforts to protect children, especially as reports dey show di dangers wey children kontinu to face.











