Passengers sleep for floor for airport, plenti travellers stranded as UK cancel thousands of flights

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Dem don cancel thousands of flights for airports for di UK sake of one air traffic control issue.
Tens of thousands of passengers dey affected sake of di disruption wey see authorities cancel 291 flights cancelled on Wednesday afta dem cancel 1,750 flights on Tuesday, according to aviation analytics firm Cirium.
Nats, di air traffic control provider, blame di disruption on technical glitch and dia boss Martin Rolfe don apologise.
E say dem go carry out full investigation afta dem admit say solving di issue don take "longer dan dem expect".
Foreign Secretary Ed Miliband say di outage dey "unacceptable" and Transport Secretary Heidi Alexander don summon Rolfe to one meeting to explain wetin happun.
Tuesday incident mark di third time in as many years wey Nats don suffer technical issues, following outages for 2023 and 2025.
Authorities don advise pipo wey wan travel by air to continue to dey check dia flights wit dia airlines as e fit take days for flights to fully resume.
Heathrow say make passengers travel go airport only afta dem don confam say dia flight go operate.
End of Di one wey oda users dey read well well
As na few aircraft fit operate, e dey clear say landings dey restricted, wey don lead to some flights wey dey unable to depart from overseas airports.
Wetin be Nats, and wetin cause di disruption?
Nats na di company wey dey manage UK airspace and air traffic control for most of UK major airport, dem claim say dem dey direct 2.5 million flights per year.
Nats say dem identify issue wit dia flight processing system on Tuesday afternoon.
E take three hours for dem to tok say dem don fix di issue, wey make dem cancel nearly 2,000 cancelled flights along wit widespread delays and diversions globally.
Di interconnected nature of di aviation network - wia planes and flight crews make several journeys a day – wey mean say di knock-on effect dey big.
Di disruption dey expected to last for days and cost millions.
Di fault dey widespread across UK and beyond, as airports for Ireland also report disruption.
According to FlightRadar, di worst affected airports na Heathrow, Gatwick, Manchester, and Birmingham.
Honeymoon flight cancelled and 'pipo para': Passengers react to travel disruption
One family tell BBC how dem spend di night for airport floor afta dem cancel dia flight from Turkey to Manchester.
Alan Jones and Kelly Fewery plus dia son and niece, from Blackpool, bin stay for Dalaman Airport for several hours sake of di air traffic control problem.
Phil White from Bexhill tell BBC say im board im flight to Lanzarote on time but im sit for tarmac for Gatwick for hours.
Sasha and James from south London suppose fly go Madeira for dia honeymoon on Tuesday bifor dem cancel dia flight.
Afta dem marry for weekend, di couple bin wan board dia flight go Funchal from Gatwick Airport wen dia flight dey cancelled.
"We spend three hours stranded for Wetherspoons, making di best of it," Sasha tok.
One woman wey stuck for Turkey afta dem cancel her flight don describe di experience as a "nightmare".
Sukie Perera, from Cardiff, say her Easyjet flight on Tuesday dey initially delayed for two hours bifor dem later cancel am.
Fotos of how pipo sleep for floor and large queues as disruption continue

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, EPA

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, EPA













