Lawmakers for Senegal move to reduce presidential powers don cause protest for di capital

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Wycliffe Muia
- Published
- Read am in 2 mins
Senegal lawmakers don pass one controversial constitutional reform wey go expand dia power more but e go reduce president power, dis don cause protest for outside di parliament.
Dem pass di reforms wit big majority afta many serious argument for parliament, show say power struggle don dey boil between President Bassirou Diomaye Faye and im former ally wey don become rival, parliamentary Speaker Ousmane Sonko.
Di govment tok say dem go take di reforms go national referendum, but dem neva announce date.
Faye and Sonko come to power togeda for 2024 wit hope of many reforms, but di partnership don scatta as dia relationship dey shake, di kontri politics dey face uncertainity.
Di relationship wey dey between di president and im former prime minister don fall for some months, as Sonko dey openly criticise Faye ova di way e dey handle Senegal debt problem.
E reach di highest for May wen Faye sack Sonko as prime minister, but Sonko, wey im party Pastef get di majority seats for National Assembly, dem choose am as di parliamentary speaker.
Di constitutional reforms wey Pastef propose go strengthen di parliament dem go get beta oversight, by giving lawmakers more power to investigate and make di govment openly tok about di agreements about di natural resources.






