South Africa President Cyril Ramaphosa comot hand from public engagements as e fall sick

Wia dis foto come from, Alexander KAZAKOV / POOL / AFP via Getty Images
South Africa President Cyril Ramaphosa don withdraw from official duties, sake of health issue, di Presidency announce.
Di Presidency for one post on dia official X account on Wednesday say di president media team advise am to rest and recova afta e return from di Brics Summit for India on Monday.
Di president don ask respective ministers to represent am for scheduled public engagements, wia possible.
Although, di Presidency no disclose di nature of di president sickness, e however dey come one day afta di Deputy President Paul Mashatile announce say im dey recova afta one minor medical procedure.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

Wia dis foto come from, Paul Mashatile/X
Oga Mashatile wey don dey sick for some time say e neva dey clear wen im go resume official duties.
"Fellow South Africans, as many of you know, I recently carry out one minor medical procedure. I dey pleased to share say my recovery dey progress well, and I dey regain strength each day.
On di advice of my doctors, I go continue to rest until my doctors advise me otherwise," di deputy president tok.
E also say im don delegate responsibilities to im team, plus oda stakeholders for govment, business and oda sectors.
Dis one mean say di kontri two top leaders dey absence from public duties.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
73-year-old Ramaphosa bin attend di 18th Brics Summit wey hold for New Delhi, India from 12–13 September 2026.
E land for India on Friday, 11 September and e address di India-South Africa Business Leadership Roundtable during di summit.
Di president also deliver remarks for di Brics Business Forum, wey focus on trade and supply chains, agriculture, women-led development, digital economy and innovation.
Also, President Ramaphosa speak for di Summit open session and participate for one closed session of Brics Leaders wey di title na; "Inclusive Global Governance and Strengthening Multilateralism".
Oga Ramaphosa return to South Africa on Monday, 14 September, and na upon im return im medical team advise am to rest and recova and take break from public engagements.
Leaders of di Brics bloc, wey include Brazil, Russia, India, China and South Africa, bin conclude di two-day summit on Sunday, wia di discussions bin focus on inclusive global growth and di Middle East.
Di absence of di two leaders dey come at a time wen di kontri officials dey face visa ban from di US.
On Wednesday, US bin announce visa restrictions wey dey target pipo wey dem accuse say dey discriminate against South Africa white minority.
Donald Trump administration bin criticise South Africa ova several issues, wey include policies wey dey aim at addressing racial inequality.
Trump say dis policies dey discriminate against Afrikaners, particularly descendants wey be Dutch and French settlers.
South Africa don repeatedly deny di claim.
E also dey come at a time wen authorities dey race against time to find di pesin or pesins wey dey murder women for Gauteng Province.
On Tuesday, high-level govment officials bin meet investigators for Gauteng afta dem discova di eighth woman bodi.
Di meeting bin hold for South African Police Service (SAPS) Gauteng Provincial Head Office for Parktown, wia dem tok about di effort wey dem dey carry on to investigate di mata and identify di criminals.
Acting national commissioner of di South African Police Service (SAPS), Lieutenant General Puleng Dimpane, say dem don arrest one suspect in connection wit one of di bodi wey dem find for July.
She tok say dem dey offer $25,000 (R400,000) reward for information wey fit lead to di breakthrough in dia investigation of wetin cause di deaths of eight women for Ekurhuleni.









