Nafdac reveal wetin cause death of NYSC member for Enugu camp, Senate demand investigation

Etimbuk Daniel wear NYSC uniform for orientation camp
Published
Read am in 4 mins

Authorities don announce wetin dem suspect say na di cause di death of one corps member Etimbuk Daniel, for di National Youth Service Corps Orientation camp for Agwu, Enugu state, southeast Nigeria.

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (Nafdac) wey carry out preliminary clinical assessment, tok say di suspected cause of death na "acute kidney injury secondary to severe dehydration and shock."

"Dis findings na preliminary (wey mean initial findings) and dem no demsefs, establish weda di medicines dem give am contribute to im death", Nafdac note.

For one statement wey di Nafdac Director-General Mojisola Adeyeye release on Monday, 19 October, she say di agency bin commence investigation into di death of di corps member afta tori spread say na fake and low standard medicine cause di death.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Nans tok how Daniel allegedly kpai for camp

On 11 October, di National Association of Nigerian Students (NANS) bin announce di passing of Etimbuk Daniel, but e neva dey clear di day wey authorities actually declare am dead.

Nans President Akinteye Afeez for statement on X tok say according to di informate dem receive, Daniel, wey be di immediate past Students' Union Government (SUG) President of Akwa Ibom State University, die sake of "fake drugs" wey dem give am for camp, afta e complain of "headache".

"According to di information available to us, Comrade Daniel bin complain of headache and dem give am some medication. Unfortunately, according to tori, im condition bin go worse afta e take di drugs. E say make dem carry am go hospital, but di necessary approval allegedly come too late, and e pass away bifor e fit receive medical attention."

"Dem tell us say doctor later identify di drugs dem administer to am as fake," Afeez tok.

Following di informate dem get, Nans say di allegations dey very deep as dem call for thorough investigation to establish wetin cause Daniel tragic death.

Senate call for probe into corps member death

Late NYSC member

Di death of di Enugu corps member bin receive national attention wen dem discuss am for di floor of di senate on 16 October.

Di President of di Senate Godswill Akpabio say, "di tori of di tragic death of NYSC corps member Etimbuk Daniel for di orientation camp for Enugu State dey deeply saddening."

E say sake of di unclear circumstances wey surround im death, di Senate don order comprehensive investigation into im death plus di state of healthcare facilities across NYSC camps nationwide.

Na Senator Aniekan Bassey bin bring di mata bifor di plenary as motion of urgent public importance.

Afta dem debate am, di Senate President Godswill Akpabio order probe into di death of Daniel as e set up one joint investigation wey involve several committees to establish di fact wey surround di corper death and assess di healthcare services for NYSC camps.

Di members of di committees go include; di Senate Committees on Police Affairs; Judiciary, Human Rights and Legal Matters; Ethics, Code of Conduct and Public Petitions; Youth Development; and Health.

Dem go carry out di investigation in conjunction wit di Nigeria Police Force plus di Department of State Services (DSS).

Dia work na to examine concerns wey relate to medical infrastructure, di availability of qualified healthcare personnel, emergency response capacity and procedures for referring critically ill corps members to appropriate medical facilities.

Di Senate President say di findings go dey important in determining further legislative or administrative interventions dem fit take to strengthen healthcare delivery across NYSC orientation camps.

Nafdac findings on cause of death

Nafdac for statement tok say di preliminary informate wey dem gada show say dem first carry di corps member go di camp clinic on Wednesday, 7 October 2026, as e show symptoms suggestive of severe malaria and history of peptic ulcer disease.

Di agency say dem treat and stabilize am bifor dem discharge am wit oral medications di following morning. E return to di clinic on Saturday, 10 October, wit 'pain for im right thigh, profuse sweating and recurrent episodes of low blood pressure.'

Sake of im deteriorating condition and poor urine output despite fluid resuscitation, di camp clinic refer am to di University of Nigeria Teaching Hospital (UNTH), Ituku-Ozalla, wia e bicom comatose. "Resuscitation efforts dey unsuccessful," Nafdac tok.

Nafdac add say according to di preliminary clinical assessment, di "suspected cause of death na acute kidney injury secondary to severe dehydration and shock."

Di agency make am clear say dis findings na preliminary and e no demsefs establish weda di medicines wey dem give am contribute to im death.

Di statement add say Nafdac officers don visit di camp clinic, dem don interview di attending medical personnel and oda staff. Dem also don collect samples of di medicines for laboratory analysis and further regulatory action as necessary.

"Di agency go take appropriate action based on di outcome of dia investigations," Nafdac declare.

NAFDAC commiserate wit di family of di deceased and dem ask di public to remain calm as investigation continue.