Wetin make all support acts for Ed Sheeran US tour to comot afta dem drop Macklemore

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Mark Savage
- Role, Music correspondent
- Published
- Read am in 6 mins
All di remaining artistes wey still dey for Ed Sheeran tour US tour don carry demselves comot afta rapper Macklemore dem drop from di tour sake of say e make pro-Palestinian remarks for stage.
Pipo wey follow comot di tour na Finneas wey be di broda of pop star Billie Eilish. Infact, e comot statement wia e bin say, "Artists no suppose to dey silenced wen dem dey tok for di oppressed".
Oda artistes, wey comot na Irish singer, Aaron Rowe and "7 years" band Lukas Graham as well as Irish fold band Beoga wey bin dey perform wit Sheeran evri night.
All dia announcements comot just hours afta Sheeran say dem no fit drag am enta public tok on top Gaza mata, and also tok say no be im make dem comot Macklemore from im tour.
Sheeran bin tok for statement on Instagram say, "Na di promoter decision make dem comot Macklemore from di tour, no be my own".
E come add say, "I no go eva let down di fans wey don plan, or I no go abandon di touring crew and di oda support acts and musicians wey dey rely on me to work and make money".
Sheeran next performance suppose hold for Lincoln Financial Field in Philadelphia on Saturday.
Im Loop tour website neva dey updated and Lukas Graham and Rowe still dey dia as special guests.
Wetin cause dis gbege for Ed Sheeran Loop Tour?
Early for dis month, Macklemore wey im real name na Benjamin Haggerty bin call for "free Palestine" and show pictures of how Gaza don scatta for di two concerts wey bin don hold for New Jersey.
Im comments bin draw vex from Jewish groups afta dat, some venues, come start to enta tour promoters say dem no wan see am for di tours again.
For im statement, Sheeran tok say e bin follow venues dem tok "at length all week to try build bride" but di promoters wey be Messina Touring Group tok say lai-lai dem no gree and off Macklemore performance.

Wia dis foto come from, Getty Images
But di statement bin no reach to calm im fans and oda artistes for di tour wey bin start to dey ginger and vex ova Macklemore removal.
Lukas Graham write for Instagram say, "we suppose to fit tok about di war, about di civilians wey dem dey kill and pikin dem wey deserve to grow up. Wereva dem dey, and whatever flag dey fly for dem dia".
Rowe wey bin follow di Ed Sheeran tour open wen e dey Australia nad enta set again for June tok say no be easy tin for am to decide say e no dey do again say, "Ed na friend to me and don change my life. I no fit thank am enough for dis".
For dia post, Beoga tok say, "As musicians, playing to crowds evri night na di stuff of dreams but to play ofr venues wey dey shut up sany pesin wey dey advocate for Free Palestine no be choice for us."
How di mata take hot like dis
Di kasala bin start for 4 September wen Macklemore bin perform for Ed Sheeran concert for di MetLife Stadium in New Jersey.
E tell di crowd say, "Di main reason why I bin wan dey dis tour na to stand for stadiums like dis and tok two words wey dey dear to my heart wey be, Free Palestine".
E come perform im song Hind Hall wey im dedicate give di pro-Palestinian protestors for Columbia University and dey use condemn Isreal military acton for Gaza as e show wetin di attacks do for di big screen.
Some of di audience bin dey hail am o but na for online dis wahala start.
Di Israeli American Council start petition make dem comot am from di tour while di campaign group StopAntisemitism tok say di rapper bin just attack im fans wit propaganda wey be claim wey singer Pink carry for head, repost for Instagram.
Di next night, Macklemore climb stage back to tell im "Jewish brothers and sisters" say "Criticism of Israel, apethied against genocide no be criticism of una". As e tok say im plan na so dem no go forget di pipo for Gaza and di West Bank.
Israel say no be gencide dem dey do say dia troops bin run self defence operatioms for Gaza and occupied West Bank as wetin dey international law.
Di Isreal military bin run campaign for Gaza afta di Hamas lead attack for southern Israel for 7 October 2023 wey kpai like 1,200 pipo and take 251 pipo as hostage.
For dis campaign for Gaza, Hamas-run health ministry wey UN believe dia numbers say, 73,780 pipo don dey killed.
'Most successful tour'
Afta days for di news, Macklemore announce on Monday say dem don drop am from di tour and accuse Robert Kraft - di billionaire owner of Gillette Stadium for Massachusetts as who run am.
Kraft don hire Ed Sheeran to play for im wedding say na true say e arrange to block im performance as im say dem no go use im venue "as platform to promote hate speech" as im say di rapper get "broader history of antisemetic rhetoric".
Kraft tok say:
"I agree wit Macklemore, plenti lives don lose and pipo don suffer well-well, but if you dey share only one side information and you ignore wetin Hamas do, na lie be dat and e go only bring more division and hate.
""But e no tok anytin about di claim say na im tell oda venues make dem put pressure on di tour. Tour promoter, Messina Touring Group, tell Rolling Stone magazine say venues tell dem say dem no go allow Macklemore perform, "which go make dem cancel di tour and affect hundreds of thousands of fans."Many of di artists wey comot for di show on Tuesday night tok say na Kraft involvement make dem take di decision. Lukas Graham tok:
"Money no give you right to own di conversation. Nobody bank account suppose decide who go tok or which suffering we go fit acknowledge."For im own statement, Macklemore say e understand di hard position wey Sheeran dey, but e still criticize di English singer say e no gree take side.
E write say: "To take side fit cost you. Money, brand deals, sponsorships, festivals, private shows, relationships and access. I don lose all those things. But e no get neutral position between oppressor and oppressed. "Im also tok say, although e only fit do two shows for di tour, if im words fit "turn di conversation back to Palestine, den na di most successful tour wey I don eva do."









