Wetin Nigerian constitution, Inec Electoral Act tok about deregistration of party and wetin be ADC fate

Inec chairmo and logos of political parties for Nigeria

Wia dis foto come from, Inec Nigeria/APC/PDP/SDP/NDC/ADC/LP/X

Published
Read am in 7 mins

Plenty reactions don follow di court ruling wey order di Independent National Electoral Commission (Inec) to deregister di main opposition political party for Nigeria, di African Democratic Congress (ADC) and four odas.

Na on Monday, Justice Peter Lifu of di Federal High Court Abuja on Monday rule say make Inec deregister di ADC, Accord Party, Action Peoples Party, Action Alliance and Zenith Labour Party on top failure to meet di constitutional requirements for political parties for di kontri.

Justice Lifu for im ruling say di affected parties fail to secure 25 per cent of di votes for di 2023 general elections in compliance wit di provisions wey dey for Section 225A of di 1999 Constitution (as amended) and di Electoral Act 2022.

Di ADC, di oda affected political parties, opposition parties and leaders don reject di ruling.

ADC strongly oppose di court ruling, as dem describe as attempt to use di judiciary to undermine democratic process, and warn say make govment no play wit fire.

"Dis judgment stand in direct conflict wit constitutional principles and all known judicial processes and procedures," ADC tok for statement.

Wetin make court order di ruling

Na di National Forum of Former Legislators bin carry di mata go court for one suit wey dey marked FHC/ABJ/CS/2637/2026.

Dem bin want make di court determine if Inec get constitutional obligation to remove political parties wey fail to meet di electoral performance thresholds wey dey Section 225A of di 1999 Constitution (as amended), and for di Electoral Act 2022 and Inec regulations.

Di plaintiff bin argue say di five political parties wey dem list as defendants for di mata don continuously fail to meet di constitutional benchmarks wey dey required to retain dia registration.

Di former legislators tok say di requirements include say dem must win at least 25 per cent of votes for one state during a presidential election or secure at least one elective seat for di national, state or local govment level.

Di plaintiff argue say di ADC plus di oda four parties no do well for di 2023 general elections and di by-elections wey Inec conduct, e say dem fail to win seats across key tiers of govment.

Among oda reliefs, di plaintiff want make di court declare say Inec get di responsibility according to di law to deregister dos parties.

Dem also want make di court compulsory di commission to deregister di five political parties.

Wetin Section 225A of di Nigerian constitution and di electoral act tok

One of di bone of contention for dis case na wetin for Section 225A of di Nigerian constitution.

Di plaintiff wey rely on di section and provisions of di Electoral Act, insist say di parties fail to win elective seats for di general and bye election or meet minimum requirements for elections.

Di judge for im ruling say di affected parties break Section 225A of di Nigerian Constitution.

However, di 1999 Nigerian Constitution and di 2026 Electoral Act as amended give di election umpire power deregister political parties on several conditions.

One of di conditions na if di political party fail to win 25% of di votes cast for Presidential election, or win one Local Government Area inside Governorship election; or (b) Win one seat for di National Assembly or State House of Assembly election; or (c) Win one ward for di Chairmanship election or one seat for di Councillorship election, Inec fit deregister am.

Dis one mean say di commission get di power to deregister political parties wey fail to win any elective position or 25 per cent of di votes for di previous round of elections for di federal, state and local govment levels.

E happun for 2020 wen one Federal High Court for Abuja hold say di commission dey within dia right to deregister di National Unity Party (NUP) as a political party for Nigeria.

Justice Taiwo Taiwo say Inec get di powers for Section 225A of di 1999 Constitution (as amended), wen e terminate NUP political party status.

Reactions to court ruling

ADC say Inec no get any reason to deregister dem, as dem maintain say dem no violate any registration requirements, and no fail any constitutional electoral-performance threshold.

For statement, di party allege say di ruling party get hand for dis judgement and warn say e fit lead to wahala.

"Di ADC go like warn say any attempt to eliminate di kontri major opposition party through judicial manoeuvring, thereby sabotaging di political aspirations of hundreds of dia candidates, na direct invitation to anarchy."

Also, one of di tok-tok pesin for ADC wey follow BBC tok say despite di high court ruling, dem go still kontinu all dia party activities bicos di case still dey for di Court of Appeal.

"First, if you look wetin di judge take base im judgment on, na Section 205. Di law tok say evri political party for Nigeria must either don take part for election for one office, or get at least 25% of votes for one state for Nigeria.

"If dem no meet dis condition, Inec get power to collect dia certificate and stop dem from operating as political party.

"Na dis law di judge say e rely on, and na why e withdraw our ADC certificate, say we no meet di requirements."

Kabir add say "Di judge forget say when dis case first start, Inec itself tell dem say ADC don meet all di requirements wey party need to remain registered.

"So wetin we dey see na distraction. Dem just wan shift Nigerians' attention from di real problems wey dey happun for di kontri. For our side, nobodi pass di law. We no see dis as serious judgment, we see am as play-play."

Wen dem ask am weda dis judgment no go discourage dia supporters, especially as di party don face plenty controversies since e start, e reply say "Na only one reason make dem dey pursue dis party up and down. Di President know say e don fail, e don put Nigerians for hardship, e don put di country for poverty, and e no get peace of mind."

E add say "E sabi say if strong opposition party dey, no state dey wey e fit confidently win, even Lagos wey be im home state. We go do evritin we fit do to make sure say democracy for Nigeria no collapse."

As for wetin dem go do next, Kabir tok say "Evribodi sabi say dis matter already dey Court of Appeal. On 22 May, di Court of Appeal give order make dem stop hearing di case until di court give final judgment."

"But di judge ignore di Court of Appeal order and continue wit di case. E come give di judgment wey e want. E turn di law upside down."

E add say "I fit assure you say even INEC no go act on dis judgment bicos Court of Appeal don already give order for di matter. We dey call all our supporters make dem kontinu dia activities and no allow dis judgment fear or discourage dem."

Di Nigeria Democratic Congress (NDC) also challenge di ruling as dem call on evri Nigerian to resist di attempt of di ruling party to turn di kontri into one-party state.

For im reaction to di court order, Osun state govnor Ademola Adeleke wey dey wan run for second term under Accord party say di deregistration of di five political parties violate di order of Court of Appeal Order.

According to statement from im tok-tok pesin, Olawale Rasheed, di govnor dia lawyers dey take all di necessary steps to right di wrong legally.

Implication of di court ruling

Di judgement, if Inec enforce am immediately go lead to di disqualifications of candidates wey dey run for elective offices for di 2027 general elections and di upcoming off-cycle governorship elections wey dey scheduled for June and August dis year for Ekiti and Osun states.

One political analyst for Kano, Sani Bala, tok say di court judgment against ADC and oda political parties wey court order make dem deregister na setback for Nigeria democracy.

E tok say wetin dis judgment mean for ADC be say di party fit face serious challenge to take part for di 2027 election if di court decision remain as e be.

Sani Bala tok say "ADC fit lose dia chance to contest for di next election for 2027 if di court judgment finally stand."

However, di analyst tok say ADC get two options if dem want come out from di situation wey dem find dia selves.

"For now, ADC need to appeal di judgment if dem want get chance to contest for di 2027 election."

"Di second option be say if dem no appeal, dem fit merge wit anoda political party for Nigeria so dem go fit get chance to participate for di election," Bala tok.