Nigerians dey face accuse of sextortion for US - Wetin be sextortion and possible jail term for offenders

Wia dis foto come from, FBI/X
Two Nigerians don land America to face prosecution on top accuse say dem dey involved in online sextortion schemes wey link to di death of one American teenager, according to di Federal Bureau of Investigation (FBI).
FBI Director Kash Patel for one post on X say di men be "high-value targets from Nigeria" wey dem extradite to di US following separate investigations.
Nigeria anti-corruption agency, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), identify dem as Mudashiru Afeez Olawale wey be 24-year-old and Adebola Festus Adekunle.
Di commission bin hand ova di suspects to authorities afta FBI investigations into di alleged exploitation of minors.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
For statement on X, di Nigerian corruption police tok say di suspects chop accuse say dem dey target boys aged between 13 and 17, dem use sexually explicit images to demand money through gift cards, bank transfers and cryptocurrency.
According to EFCC, one case involve one 13-year-old boy wey pesin contact on Instagram and ask am to ask am to send nude fotos. Later di pesin begin threaten di boy say im go share di fotos on social media, if e no pay money.
"Di threats bin continue even afta di teenager tok say im go kill imsef," EFCC tok.
Oga Patel allege say "one of these alleged schemes don result in di death of a child".
EFCC say di FBI later seek assistance from Nigerian authorities in identifying and investigating dos wey allegedly dey involved, and add say dia investigation lead to Adekunle arrest.







