Why schools dey lockdown for Cameroon as new academic year dey start

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Two Anglophone regions for Cameroon dey observe lockdown wey separatists impose, wey make schools to shutdown as di new academic year begin.
Di lockdown don also affect economic activities and movements for di English-speaking regions.
For di Northwest and Southwest, most of di schools close, wia many students and teachers choose to stay for house to avoid fight back.
Although some govment schools for urban areas witness small reopening of classes dis Monday but di students for di oda French-speaking regions resume dia learning normally.
Tins like dis don happun bifor wen about 600,000 pikin no go school for three years wen crisis start for 2016 and some parents don take dia pikin go oda areas.
For nearly ten years, armed conflict for Cameroon two Anglophone regions don affect education, displace hundreds of thousands, and kill at least six thousand odas.
Why di schools dey lockdown
Di koko wey dey cause dis kasala na say separatists don impose one-week lockdown for both regions to stop school resumption.
One teacher of Philosophy for di Anglophone city of Bamenda tell di BBC say e go will stay home until di end of di lockdown.
E say di principal of im school advise dia staff and students to dey vigilant and only resume wen conditions don become safe.
Dis tension na sake of di presence of several separatist factions wey cause kasala afta dem give stay-at-home order wey go long between one to two weeks.
While many students suppose return to school afta di lockdown period for di English-speaking regions, di separatists' dey enforce say make dem no resume sake of say di security situation still neva clear.
On Monday morning, some sources for di Southwestern city of Buea tell di BBC say security forces bin dey patrol di streets.
Last week, separatists fire several gun shot near local market wey make traders and passersby to fear and panic.
Many believe say di move na warning against dose wey dey plan to go against dia lockdown call.
Ahead of di new academic year, di Ministry of Defence bin hold security assessment meeting wit oda govment officials.
Di authorities say di overall security situation dey under control, although dem note say some concerns dey for some parts of di kontri wey include di conflict-hit English-speaking regions and di Far North region wia Boko Haram insurgency dey.
"Nationally, while di overall situation remain under control, detailed overview make am possible to evaluate all points of concern across di territory wey include terrorist activities for di Far North; residual "ghost town" call on Mondays for certain localities within di North-West and South-West regions."
"Attention also dey directed toward securing di eastern and southern borders, regulating mining activities, monitoring di maritime against piracy."
Di Ministry of Defence don order saye make security pipo do korrect security operations, in collabo wit administrative authorities and local stakeholders.
For 2019, di United Nations Children Fund, Unicef, say ban on education affect about 600,000 children for Cameroon, with more dan 80% of schools shut.
During dat time, at least 74 schools dey destroyed for di troubled regions.
For one incident, dem kidnap 80 pupils, dia principal and a teacher wey disobey di lockdown for 2018 bifor dem release dem about a week later.
Separatist fighters deny say dem no dey involved, but di govment blame di jaguda pipo for di abductions.
Dis whole kasala get connection wit di govment decision to increase di use of French for schools and courts wey dey mainly for English-speaking regions since 2016.









