Tanzanian president Samia Hassan lose husband

Samia Hassan

Wia dis foto come from, Alexander KAZAKOV / POOL / AFP via Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Hafidh Ameir Hassan, husband of President Samia Suluhu Hassan, don die.

Vice President Deogratius Ndejembi make di announcement on Monday, 7 September.

Ndejembi say Ameir die for 8am for di Emilio Mzena Memorial Hospital for Zanzibar, wia e bin dey receive treatment for heart condition.

"Na wit great sadness I inform you of di death of Mr Hafidh Ameir Hassan, husband of di President of di United Republic of Tanzania, Samia Suluhu Hassan," Mr Ndejembi tok.

E extend im condolences to President Hassan, her family, relatives and friends, as well as Tanzanians afta di death.

Ndejembi say funeral arrangements don start for Kizimkazi, Zanzibar.

President Samia neva tok anytin about di death of her husband as at di time of dis report, however Tanzanians don begin mourn and African leaders and pipo don dey pay tributes.

Kenya President William Ruto for im tribute say im receive di news of Oga Hassan passing wit great sorrow.

E extend im condolences to di President and di pipo of Tanzania.

"President Samia don lost a lifelong companion, her children a beloved father, and Tanzania a distinguished son.

"Kenya stand wit our Tanzanian brothers and sisters for dis moment of grief. May Almighty God comfort President Samia and her family, give dem strength through dis difficult time, and grant Hafidh Ameir Hassan eternal rest," Oga Ruto add.

Burundi President Evariste Ndayishimiye also express condolence to di pipo of Tanzania. "For dis hour of grief, Burundi stand firmly beside our Tanzanian brothers and sisters. May di Almighty grant President Samia and her family comfort and strength for dis difficult moment, and may He grant eternal rest to di soul of Hafidh Ameir Hassan".

Africa CDC for dia tribute tok sorry to di president and say dem stand wit her during dis time of sorrow.

Hafidh Ameir na agricultural academic wey specialise in agriculture. E mostly keep low public profile, as pipo no too dey see am for public.

E marry Samia Suluhu for 1978, bifor she enta national politics. Di couple get four children - three sons and a daughter.

Ameir bicom Tanzania First Gentleman wen im wife bicom president for 2021.

E no dey too appear for public alongside di president, although, pipo dey occasionally see dem togeda for official and political events.

Dia daughter, Wanu Hafidh Ameir, also na politician wey currently dey serves for Zanzibar House of Representatives for di National Assembly.