Breaking Bad actor RJ Mitte don die at di age of 34

Wia dis foto come from, Getty Images
US actor RJ Mitte, wey dey best known for im role as di rebellious son of drug kingpin Walter White for di drama series Breaking Bad, don die at age of 34.
"Na wit profound sadness we dey share di tragic passing of beloved actor, philanthropist, and passionate disability rights advocate RJ Mitte," im representative tell BBC.
Mitte die for Brownsvillle, Texas, on Monday, 12 October. Im publicist confam to Reuters say e take im own life.
Mitte, wey bin live wit cerebral palsy, bin use im own experience for im role as Walter 'Flynn' White Jr for di Emmy-winning drama series wey feature Bryan Cranston and Aaron Paul.
E earn Screen Actors Guild Award for 2014 for im work on di series.
Bryan Cranston play di role of one high school chemistry teacher wey turn to crime to support im family afta doctors tell am say e get cancer.
"I meet am wen e be only 14 years old afta dem cast am as Walter White Jr., one role wey e play wit plenty joy and excitement," Cranston tok.
"Dat boy no too get experience wen we start to shoot di pilot for February 2007, but small small we watch am grow bicom one really good actor."
End of Di one wey oda users dey read well well
Cranston hail Mitte for im advocacy work for performers wey get disabilities, and note say e no ever allow im cerebral palsy "be excuse for anytin."
"All dat promise and potential wey e get, na big loss now," di actor write, and add say e "really enjoy spending time wit am throughout di years for di series, and even afta di spotlight on Breaking Bad fade."
E tok say "e pain to hear say e take im own life."
Cranston add: "I go miss you, my son."
Mitte representative, Sean Reilly, tok for one statement to BBC say: "Mitte bring authenticity to di role and build one platform around disability awareness and inclusion."
Di star also serve as ambassador for United Cerebral Palsy and Shriners Children.
E create The Mitte Foundation to support charity work and community initiatives, as e use im platform "to challenge stereotypes and promote beta representation for pipo wey get disabilities," Reilly tok.
For one statement wey Hollywood Reporter share, Aaron Paul, wey play Jesse Pinkman for Breaking Bad, tok say e dey heartbroken and no know wetin to tok.
"RJ, I love you, my friend. We go miss you," e tok. "And anybodi wey dey read dis, abeg know say dem love you and you no dey alone. Always remember dat."
Dean Norris, wey play Mitte uncle Hank Schrader, post say although "RJ no play my son for TV, I always dey look afta am as one young boy on set."
"E be one very kind young man and we go miss am well well," Norris write.
RJ Mitte: Profile
Mitte, wey grow up for Louisiana, be teenager wen e audition for di breakthrough role afta e move go Los Angeles in 2005 to support im younger sister acting career.
E bin tok bifor say im first audition for Los Angeles na for one California state public service announcement anti-meth advert.
"As time pass, I come audition for Breaking Bad, wey still be, for my opinion, one anti-meth project bicos e no end well for anybody," e tok earlier dis month for Joe Vulpis Podcast.
Im character base on Gilligan late friend wey get more serious cerebral palsy condition and dey use forearm crutches, sometin wey Mitte no need.
Pipo see Mitte as person wey play di role wit honesty and make am easy for pipo to relate wit, as e dey crack jokes as one teenager wey im health condition no dey mentioned for di series.
Breaking Bad air for American cable broadcaster AMC for five seasons from 2008 to 2013.
Afta e bicom famous, Mitte fight for more different roles and beta representation of characters wey get visible and invisible disabilities.
"Any time award season come around, we always hope to see different projects wey represent all of us, for bodi and mind," e tell BBC for 2021.
"To watch awareness about disability representation kontinu to grow don sweet well well, but breakthroughs sometimes dey happun bit by bit instead of one big change," e tok.
Oda screen projects wey Mitte act include Hannah Montana, Switched at Birth, Westhampton and im latest project, Talking to Strangers, wey come out earlier dis year.
























