Police react to tori say bandits relocate kidnapped victims from Oyo to Kaduna, as Makinde declare curfew

Wia dis foto come from, Seyi Makinde/Facebook
Tori say bandits don relocate children and teachers wey dem kidnap for Oyo state na lie, police tok.
One video wey dey spread bin dey tok say di bandits don transfer dia victims from Oyo go Kaduna state.
Di police tok say wetin dey inside di video no be true, and di pipo wey make di video wan mislead di public.
All dis dey happun as Oyo state govment impose 16-hour curfew across 10 local govment areas for di state as dem continue to search for di children and teachers wey dem kidnap for di state.
BBC News Pidgin bin don report how gunmen bin attack Ogbomoso community on Friday, 15 May 2026, and kidnap primary school pupils and teachers from LA School and Community Grammar School, Ahoro-Esinele.
Local tori tok say na about 46 pipo bin dey affected, including seven teachers and 39 school children. Di bandits kill one school teacher during di attack, and later also kpai anoda teacher inside di forest.
Di terrorists ride motorcycle attack enta di community kidnap schoolchildren and teachers from Community High School, Ahoro-Esinele, and Yawota Baptist schools.
Di restriction go run daily from 4:00 p.m. to 8:00 a.m., and e go last for 48 hours in di first instance.
According to one memo di secretary to di state govment, Musibau Babatunde on Tuesday, say di curfew go start from Wednesday June 24, 2026 and e go last for 48 hours in di first instance.
Di restriction go affect local govment areas wey dey near di Old Oyo National Park.
Di areas wey e go affect go include;
- Oriire (Headquarters: Ikoyi-Ile)
- Oorelope (Headquarters: Igboho)
- Irepo (Headquarters: Kisi)
- Saki West (Headquarters: Saki)
- Saki East (Headquarters: Ago-Amodu)
- Atisbo (Headquarters: Tede)
- Itesiwaju (Headquarters: Otu)
- Iseyin (Headquarters: Iseyin)
- Olorunsogo (Headquarters: Igbeti)
- Atiba (Headquarters: Offa-Meta)
Di govment release dis statement afta di police debunk one false information say dem don use helicopter transport di kidnapped victims from Oyo state go Kaduna state.
Forty days later di victims wey dey between di age on 2-16 still dey for captivity.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Ayanlade Olayinka, tok-tok pesin to di Oyo State police command on Tuesday deny report wey dey circulate for di state say students and teachers wey di gunmen kidnap for Ahoro-Esiele and Yawota for Orile local govment areas dem don carry dem go Kaduna State wit helicopter.
Di police tok say wetin dey inside di video no be true, and di pipo wey make di video wan mislead di public.
"Di command wan make am clear say di video wey dem tok about no be true at all, unverified, misleading, and e no get any factual basis," di statement tok.
"Di claim no get any credibility, e no get substance, and e no meet di standard wey we dey expect for information relating to such sensitive security matta like dis."
Oyo police tok say dem dey work hard and tiredlessly to rescue di victims so di kidnap victims gomeet dia family safely alongside oda security agencies.
Police tok say pipo wey dey spread di false information wan cause unnecessary pain and lac of trust in di security personnel wey dey work tiredlessly to rescue dis victims.
Ayanlade warn say dem go prosecute any pesin wey dey spread false information about di kidnap inline wit di law.
In 2025, for Kwara state one deadly attack happun for Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, Eruku town, Ekiti local govment area, wia jaguda pipo bin open fire on top pipo wey gada to pray inside di church.
Two pipo die for di attack and some odas wunjure - di attackers also kidnap several pipo from di worshippers.
After several negotiation wit di gunmen dem later release di victims.
Also, for Owo in Ondo state, gunmen bin attack one church and kill residents in 2022.








