Wetin we know about IED explosion for Lagos market

Wia dis foto come from, Screengrab/Lagos Police Command
One pesin injure on Monday wen one car explode for shoe materials section inside Mushin market for Lagos, Nigeria commercial capital.
Di incident happun inside di market around early mor-mor on Monday for 22, Wey Street in Oke Mushin wia dem park di car inside di market.
Residents tok say pesin plant improvised explosive device (IED) under one Toyota Sienna wit registration number Lagos AAA11FX, but dem no know who plant am.
Fatai Tijani, di Lagos State police commissioner, tok say dem receive di report about di explosion and quickly depoly EOD operative go di area.
Tijani tell tori pipo say dem find di IED wia dem put am under di vehicle for one of di passenger side and e detonate wen dem start di engine, resulting in one pesin wey injure from di incident.
"We quickly deploy our EOD team afta we receive report of explosion. Di IED dey under di vehicle for di passenger side. E blow wen dem start di vehicle," di police commissioner tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Inside di video wey BBCPidgin see, e show one Toyota Sienna wia one of windows don burst and dem replace am wit transparent polythene wey dem tape.
Also, some part of di body of di vehicle on di left don burn and explosive materials dey ground wit shattered glasses.
According to di residents, wen di owner of di vehicle start di engine for morning den di bomb blow for di passenger side and injure am.
Witnesses tok say dem no get any information about di owner of di car but di car don dey park for two to three months .
Dis incident make residents and shop owners for di community begin fear, and dem quickly call emergency responders.
Inside one memo on Monday, Tijani tok say dem don visit di area wia di incident happun inside Mushin market to check wetin happun afta di locals report di explosion.
E tok say dem quickly send EOD-CBRN Unit to di scene to check di place and block di area well to conduct thorough check, search, and recovery operation, and dem later confam say di place dey safe ans free of any IED threat.
Di Commissioner of Police ask di residents make dem calm and continue to do dia lawful activities, while e reassure dem of adequate security to protect dia lives and properties.
"Di Commissioner of Police, Lagos State Command, CP Tijani Fatai, today visit Mushin to assess di report of IED scare," di police command tok.
"Following di distress call of di alledged explosion early mor-mor today, operatives of EOD-CBRN Unit immediately deploy to di scene."
Wetin be di security situation for Southwest
Dis incident don make residents begin dey fear, as dem dey recall di high level of insecurity for South-West, Nigeria.
Last month, news bin break say gunmen attack three schools for Ahoro-Esinele, Ogbomoso, for Oyo State, southwest Nigeria.
Di terrorists ride motorcycle attack enta di community kidnap schoolchildren and teachers from Community High School, Ahoro-Esinele, and Yawota Baptist schools.
Local tori say dem kidnap 46 pipo, wey include seven teachers and 39 schoolchildren.
Thirty-eight days later, dem don kill two teachers, and children between di age of 2-14 still dey captive.
However, di state govnor Seyi Makinde tok say im fit replace di children wey dem kidnap as e dey beg di gunmen make dem release di victims.
Also, for Kwara state on deadly attack happun for Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, Eruku town, Ekiti local govment area, wia jaguda pipo bin open fire on top pipo wey gada to pray inside di church.
Two pipo die for di attack and some odas wunjure - di attackers also kidnap several pipo from di worshippers.
After several negotiation wit di gunmen dem later release di victims.
For Owo in Ondo state, gunmen bin attack one church and kill residents in 2022.
Safety tips on IED
Inside one document wey di Nigeria Air Force publish for dia website, dem share safety tips on suspicious improvised explosive devices (IEDs)
Wen you see suspicious objects/IEDs:
1. No panic; move far from di suspicious objects; watch di crowd, vehicles wey nobody dey attend to and places wey don damage; no try to move or touch any suspicious object.
2. Report such immediately call 112 Emergency Line, nearest police station, or contact any security person.
3. During bomb explosion – Crawl under study table or solid object if tins dey fall and stay dia for at least one minute.
4. Stay far from glass or doors like windows, mirrors, cabinets and electrical stuff
5. Follow police or safety personnel; evacuate building as soon as possible; no forget pipo wey get disability wey fit need help
6. No move seriously injured people unless dem dey for real danger; no go near gas pipes, fire risk or kitchen; no use elevators, lie flat for ground and open mouth dey breathe small small
7. Afta explosion, comot from di building fast; no stop to collect your tins or make calls; Bystanders no suppose rush go di explosion area to avoid second explosion.
8. Open door carefully; dey watch for falling objects or debris; no use phone, mobile phone or hand radio; electrical sparks fit trigger oda bombs.








