New Ghana coach Carlos Queiroz tok about team selection, pressure, risk and oda tins ahead of 2026 World Cup

Wia dis foto come from, GFA
Di Ghana Football Association (GFA) don unveil di new Black Stars coach Carlos Queiroz wit 50 days to di 2026 World Cup.
For one press conference afta di 73-year-old bin arrive for Ghana, im tok say di Black Stars coaching job be im 'biggest test yet' for im 40 years of coaching.
Di football association fire coach Otto Addo afta Ghana lose five straight international friendly games - di latest defeats to Austria and Germany.
Earlier for April dem announce say dem select Portuguese coach Carlos Queiroz to lead di kontri to di World Cup for four-month contract wit di option to extend am afta di tournament.
Football fans bin dey worry say di new coach no get enough time to observe and select di players wey go represent di kontri for di World Cup, but di GFA say di coach make ready to use im experience to carry di team to do beta for di US, Canada and Mexico.
Carlos Queiroz dey begin im new job wit five of im own backroom staff wey dem go combine wit di oda local technical staff to guide di team to di World Cup.
Journalists and oda football pipo gada to witness di unveiling of di coach wey dem ask am some questions.
Dis be some of di tins im tok:
'Nobodi dey own di Ghana shirt, we go give everibodi di right opportunity'
Di former Iran, Egypt, Portugal and Real Madrid coach say nobodi dey above di team.
"Nobodi dey own dis national team shirt. Di team be for evribodi."
Coach Queiroz add say "our job be to give fair opportunity to evrione, di pipo wey deserve to be dia go dey dia wey we go open di window and door for odas to enta if dem deserve to dey dia also."
Wen im dey answer question about di criteria to select players for di tournament wen im no get enough time to monitor di players, Queiroz tok say "players gatz show say dem dey capable, fit and passionate wey dem get experience".
Im also add say di players for dey perform well for dia clubs.
We need players wit 'egos and personality' for di team
Some fans bin dey worry about how di coach go fit to handle some of di players wey be stars for dia clubs.
Carlos Queiroz wey don manage plenti top players for im 40-year coaching career say players wit ego no be di problem.
Im say: "I no dey tok about names, di team dey important first.
"I no tink say players wit ego be di problem; we need egos, we need players wit personality for di national team. My job be to put dem togeda for di good of di team."
Carlos Queiroz say di Ghana job be im biggest job sake of di short time im get bifor di World Cup.
But im confam say "I be winning coach wey we go try to select di best team for di tournament".

Wia dis foto come from, GFA
'Ghana go perform strongly for di World Cup'
Sabi pipo and oda journalists bin ask di coach which level im go take di Black Stars reach for di World Cup since di kontri comot di group stage for di last edition for Qatar.
Ghana im best performance happun for 2010 wen dem reach di quarterfinal bifor dem lose to Uruguay for penalties.
Coach Carlos Queiroz say im go select good team to "try and fight for di national team for di fans and di pipo."
"All di teams for di World Cup dey play to win games, we also get di same objectives and desire. We gatz start di game wit belief say we fit do am, we gatz fight, wit dis attitude, we go get results."
Im also add say "we gatz take di games one afta di oda - first we gatz focus for Panama to win dat game, den we prepare for di second game and den di third".
"We go perform strongly for di World Cup."
Coach Carlos Queiroz no dey fear to take risk
Coach Carlos Queiroz bin win six titles for im coaching career - wey im coach for different kontris and continents.
Wit di way di GFA bin dey demand results from previous coaches, Carlos Queiroz say im no dey fear to take risk.
"For my life, I neva dey fear to take risk, I know say anoda day go come, wey we go try again," Carlos Queiroz tok.
Im explain say former South Africa president Nelson Mandela bin teach am to task risk and not to fear anytin.
"Mandela teach me many years ago say we win or we learn, dat be di philosophy I get for many years now."

Wia dis foto come from, GFA
We go overcome di issue of timing and select di best local and foreign players
Carlos Queiroz gree say time no dey to monitor all di players for di local league and di foreign players.
Im also gree say some of di kontri best players don hurt wey dem no fit dey ready for di World Cup.
But di 73-year-old say im go do im best wit im team.
"I no get plenti time to watch di players for Europe and dose for di local league for Ghana, but I get two staff - one side go monitor players for Europe wey di oda staff go monitor di local players. Dis backroom staff go do all di groundwork to find di players and put dem for database."
Queiroz say afta dem get di names, "we go see di players well for action for some pre-tournament games wey we go select di ones wey go dey part of di squad".
Di Ghana Football Association tok-tok pesin Henry Asante Twum say di Black Galaxies wey be di Ghana team for local league players dey prepare to face Mexico for international friendly wey go happun for 22 May 2026.
32 local-based players currently bin dey camp ahead of dat game.
Coach Carlos Queiroz go watch dia training sessions wey im go also watch dem for dat friendly match against Mexico - to allow am spot some local talents wey fit dey among di World Cup squad.
Coaches gatz up to 1 June to name dia squad for di World Cup.
Ghana go begin dia tournament wit match against Panama, bifor dem go meet England and Croatia for Group L.










