Presidency announce arrest of suspect wey allegedly dey behind Tinubu AI-generated audio

Wia dis foto come from, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu/Facebook
Di Nigerian Presidency don announce di arrest of one suspect wey dem accuse say e dey behind di AI-generated audio of President Bola Tinubu.
Bayo Onanuga wey be di Special Adviser to di President on Information and Strategy on Thursday, 4 June say di Inspector General of Police crack team gbab one Ifechukwu Dennis wey allegedly dey behind di audio.
"Di IGP crack team don arrest Ifechukwu Dennis wey originate di fake voice wey e pass on to im gullible targets as President Tinubu voice. Dennis bin dey arrested for Benin. Di police go issue official statement," e tok.
Pesin bin add AI-generated voice note wey dem use President Tinubu voice do to one VDM video.
On Wednesday 27 May, 2026, Onanuga bin quote one X handle wey post di video.
According to our search, VDM on Monday 25 May, 2026, post video of imsef on im Instagram page wia e sidon, e play di video of anoda social media influencer King Mitchy wia she dey refer to am and im necklace.
Afta King Mitchy video, VDM kon play di video of President Tinubu wia e promise say Nigerians go get electricity, if not, make dem no vote am in di second time.
For di intro of di video, VDM say: "You see dis next video wey I wan play, I go come know weda dem don cook your mind, una wey wan support Bola Tinubu."
E kon play President Tinubu video.
But pesin kon pick dat same VDM video, put AI-generated audio of Oga Tinubu, to make am look like say VDM dey push di audio.
Di AI-generated audio of President Tinubu say: "Dem dey try comot me from dis position, dat no possible. Mind you, I go win dis election, I no care wetin dey happun, Nigeria deserve am becos wen I dey run as President, dem no want me, but now all of a sudden, dem want make I rescue dem from insecurity."
For inside di AI-generated audio, di voice also say im "call Peter Obi to step down but e refuse" and kon add say im go "make sure say di insecurity affect di southeast more".
Dis na wetin Onanuga write about di doctored video: "Dis VDM need to face di weight of di law as e dey share fake audio of President Tinubu. Dis na clear case of abuse of di social media platform."
Onanuga later realise say no be VDM add di audio to im video, but e no come social media to react to di error on im part.










