Oyo Assembly Speaker reject negotiation wit bandits over kidnap of schoolchildren and teachers

Foto of Adebo Ogundoyin, Speaker, Oyo State House of Assembly

Wia dis foto come from, HON. ADEBO Ogundoyin/Facebook

Published
Read am in 4 mins

Di Oyo State House of Assembly say dem no go gree for di bandits as dem move against di motion to negotiate wit di bandits wey kidnap di schoolchildren and teachers.

Tok-tok about dis kidnappings for Oyo and Borno states still dey go on as pipo dey hope to hear beta tori about dia rescue.

For plenary sitting on Wednesday Speaker of House, Adebo Ogundoyin clear di air about call for negotiation wit di bandits.

For one video wey capture di Oyo State House of Assembly sitting on Wednesday di Speaker dem no go negotiate wit di kidnappers sake of say dia demand get as e be.

"If e dey your hand you go negotiate wit terrorists? If terrorists ask for weapons, money, concession of future laws of dis land as part of dia ransom, If you be di govnor you go accept dis kain ransom? You accept make dem integrate doz pipo into dat community?

We no sabi di details, so abeg make we dey sensitive and calm, una no sabi di details. Di more you negotiate wit dis pipo, di more you dey make dem bold"

Since 15 May jaguda pipo kidnap dis schoolchildren plus dia teachers for Oriire Local Govment Area of Oyo State south-west Nigeria.

President Tinubu bin condemn di killing of schoolteacher wey bandits kidnap and im order immediate rescue and security pipo say dem dey try dia best to safely rescue dem.

Dis na afta Oyo State Govnor, Seyi Makinde confam say gunmen kill di mathematics teacher wey dem kidnap among oda seven teachers and schoolchildren wey dem abduct.

Inside statement by di presidency, di president tok say security operatives go rescue all di remaining victims while e charge di national assembly make dem do quick enact di law for di creation of state police.

Wit all dis plenti tok-tok dis victims neva still come back.

Wetin di bandits dey really ask for?

According to one sicial media post wey dey fly upandan, di terrorists dey allegedly request for money in billions of naira.

Dem dey ask di Oyo State govment to free some of dia members wey dey inside prison for di state.

Dem dey also ask for consession of some of di law for Oyo State wey go favour di bandits sake of land and oda tins.

Even though di BBC neva independently verify dis tori, e dey inline wit some of di tins wey di Speaker of di Oyo State House of Assembly tok for di video.

Dis no be di first time wey di issue of negotiating wit bandits and kidnappers dey cause tok-tok.

Over di years plenti mass kidnapping of schoolchildren, students especially girls schools full for news but e neva dey clear how govment dey take rescue dem.

Kontri pipo go hear say di kidnappers later release dem but quesions dey always dey around how govment take rescue dem.

Pipo dey ask if Nigeria govment dey pay dis bandits ranson or e get oda tins wey pipo no know about.

But dis Oyo case dey different as di House of Assembly don make am clear say dem no go negotiate wit di bandits wey dey make demands anyhow.

For December 2020 Katsina State govment bin announce say dem rescue di Three hundred and thirty-four school boys dem rescue di three hundred and thirty-four school boys of Government Science Secondary School wey Boko Haram kidnap.

Na di Secretary to di Katsina state goment, Mustapha Inuwa bin give di informate say, Boko Haram don release di kidnapped Kanakara school boys.

Di same tin bin happun for November 2025 wen Kebbi State govment no gree to pay ransom but dem rescue students wey bandits bin kidnap.

Dis bandits bin also kidnap schoolgirls from one Catholic School for Niger State.