'E pin me to di door' - Uniosun student tok about alleged military assault as Nigerian Army react

Wia dis foto come from, NANS/Nigerian Army
Students of Osun State University (Uniosun) narrate her ordeal how some men wey wear military uniform enta dia hostel to assault dem.
Di sojas dey alleged to be from di Army Depot wey dey Osogbo and tori be say dem storm hostels wia students dey stay for night.
According to di president of di National Association of Nigerian Students (Nans), Akinteye Babatunde, e say di Army recruits "invade student hostels to assault several students, inflict injuries on many."
"Dem reportedly force some of di victims to transfer money to dem. As of dis moment, some of di affected students dey receive treatment for di hospital," di students president tok.
According to video wey go viral and di ones wey di Nans president share for social media, e show wia men on military uniform dey in rowdy session wit some pipo.
Some of di videos also show some students wey alleged say di army guys assault dem and also break dia windows.
Later, anoda video show di uniformed guys dey waka in group back, but we no get di numbers of dem wey go di hostels to allegedly assault students.
Dis incident happun for night of Monday 29 June, 2026, and authorities say dem don begin chook eyes inside di matter to know wetin really happun.
Di leadership of di students don send warning give di Nigerian Army make dem find di officers wey carry out di at and make dem face di law.
Dem say students no go gree make any officer of di Nigeria Army dey brutalise dem, adding say all forces of students go resist dat kain action.
"Dis alleged act of brutality and injustice by personnel of di Nigerian Army dey unacceptable and no go dey tolerated."
"We demand investigation, di identification of all dose wey dey responsible, and make you hold dem accountable in accordance wit di law," Nigeria student president say.
'E pin me to di door' - student recount ordeal
One of di students wey dey for di hostels wey di Army guys burst enta share her experience for di hand of di officer.
She say one of dem first ask make she open her door and she dey wonder who be dat, na so dem enta her room.
According to her, her roommate no dey around di night wen di incident happun as di uniformed men dey ask how many pipo dey inside di room.
"I dey my hostel wen I notice say dem dey around, later we begin dey hear noise again, dem begin point dia torchlight to my room, I ask who be dat, di next tin na wen dem ask me to open my door."
Di female student Ademola Jesumbo tell local tori pipo OsunDefender for video interview, say di army officer pin her to di door of her toilet.
She say na one pesin first enta bifor di second pesin come follow and she dey beg dem make dem leave her alone but dem no gree.
According to her, na wen she begin dey shout di army officers come comot.
"Dem ask how many of us dey hia and my roommate no dey around dat time. E come pin me to di door, say I go like am make I no shout, I beg am make I comot."
"As I move go di door, one of dem come in say make I calm down, I begin dey shout, dem come comot wen I shout."
Nigeria Army react to di UNIOSUN incident
Di Nigerian Army for dia reaction describe di incident as misconduct.
Major Yahaya Ibrahim, wey be di Army Public Relations Officer for Depot Nigerian Army, Osogbo, e say dia duty na to protect students and no action of intimidation go dey acceptable.
"Di Commandant, Depot Nigerian Army, Osogbo, note wit concern di press release by di National Association of Nigerian Students, Southwest Zone D, regarding alleged misconduct by some army personnel," e tok for statement.
Army say dem go investigate di matter and punish anybody wey dem find guilty.
"In line wit military regulations and di values of di Nigerian Army, di Commandant don order investigation to find di facts of di incident and bring perpetrators to justice."
"No student or law – abiding citizen suppose eva feel unsafe or be subjected to harassment, intimidation or assault by dose wey dey trusted wit di security of lives and property."
Di army confam say di actions of di officers no be part of di training of recruits for di army Depot but dem go 'diafor assure say any personnel wey dem find guilty go face di full weight of military law."









