'Dis loss dey too much to bear' - Adichie share moments of her son Nkanu wit family bifor im death for Euracare Hospital

Wia dis foto come from, Luka Dakskobler/SOPA Images/LightRocket via Getty Images
Nigerian writer and award-winning author Chimamanda Adichie share beautiful moment of her son Nkanu bifor e die for Lagos-based Euracare hospital.
Chimamanda for her letter describe di kain pesin wey her twin son be and how dem love am for di family.
Na for January di tori of di death of Chimamanda son bin show for public afta one statement from Omawumi Ogbe who be di tok-tok pesin for Chimamanda, say little Nkanu die on Wednesday, 7 January, 2026"afta a brief illness".
"Di family dey devastated by dis ogbonge loss, and we dey beg make dia privacy dey respected during dis incredibly difficult time," di statement tok dat time.
Now, Chimamanda hersef come out to give detail of di beautiful moment wey her late son share wit di family bifor e leave di world.
She say her twin boys na precious and perfect gifts wey she and her husband dey so grateful to give birth to.
"Dem bring us and dia older sister, so much happiness," Chimamanda describe her twins.
Chimamanda say Nkanu, wey be di older twin and 'first Son, dey named afta dia grandfather, wey be obstetrician-gynecologist Dr. Nkanu Esege.'
She say her pikin dey veri intelligent, loving and also caring to im oda broda since dem announce dia birth for 2025.
Chimamanda Adichie bin shock di world in February 2025 wen she reveal to one tori pesin for UK say she and her husband, Dr Ivara Esege, get twin boys wey dem born through surrogacy.
Meanwhile, afta di incident happun for Janaury, Lagos State govment order investigation into di circumstances wey surround di death of Adichie son.
Di Lagos State govment condole wit di family of di author and say Govnor Babajide Sanwo-Olu don direct di Health Facility Monitoring and Accreditation Agency (HEFAMAA) to immediately commence thorough, independent, and transparent investigation into di circumstances wey surround di incident, "wit view to unravel di immediate and remote causes of di death".
'Nkanu na Daddy boy'
Nkanu emotional intelligence dey unusual for im age. E be di bigger of di two, but di softie. If you give am toy, e go immediately want anoda to give to im broda.
Chimamanda rememba 'one day last December' wia her late son hear wen she dey complain about her knee pain afta workout.
Na so her pikin begin rub her mama knee, saying, "Mama, sorry."
"E go randomly get on di sofa and stand up and give me tight hug. If I say, "Kiss for Mama," e go immediately lean forward and present im lovely lips."
Chimamanda describe her late pikin as 'absolute Daddy Boy' sake of say na only im papa e dey allow to put am to bed for night.
Di author say Nkanu love to dey siddown for floor wit her to look at picture books and also to play round di house wit im papa.
"E love to have im extended family togeda. If we all gada for di living room and one pesin get up to leave, Nkanu go cry. E wan chop evri adult food," di author describe im son.
'Dis loss dey too much for us' - Adichie
Chimamanda say im late son get climbing skill as e dey jump ontop table and also try get ontop kitchen counter.
" E get sense of humour wey dey delightful. Im laughter dey lift spirits."
"We get two highchairs for di dining room, two car seats for di car, two toddler beds for di bedroom. And now only one toddler."
Di author say di death of one of im twin son Nkanu dey brutal, unfair and careless wit deep pain.
"In truth, dis loss dey too much for us, e dey worry us. As each day pass, di darkness dey black even more."
"We don endure losses for di past but dis dey singular for di ability to permanently change di shape of di world."
Chimamanda say di death of her son na like say dem rob her of di blessing to raise Nkanu and family members dey mourn di loss.
She add say her second twin son dey ask of im broda.
"Our ten-year-old daughter don shut down. Our son dey confused and ask for im twin. Our relatives wey adore Nkanu dey suffer. Losing Nkanu has shattered our lives and our hearts.
"To lose a child na parent worst nightmare. Di least any parent wey don suffer such loss deserve na di peace and privacy to grieve," she tok for her letter.
Howeva, Chimamanda say dem still dey drag some issues wit di hospital wey di death of her son happun.










