Players wey go retire from international football afta 2026 World Cup

more players are expected to retire the world cup

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Some ogbonge players use di World Cup as dia final appearance for dia national team
Published
Read am in 7 mins

Di 2026 World Cup don enta di business stage, wia di boys dey separate from di men.

Some ogbonge teams already comot di competition wey those pipo describe as dark horses, still dey di tournament.

For Africa, eight of di 10 kontris comot, only Morocco and Egypt remain.

Di Pharaohs get R16 match against Argentina on 8 July at 4PM GMT wey Morocco go jam wit France for di quarterfinal.

Di tournament don already show excellent goalkeepers, new talents emerge, wey some of di big boys dey stamp dia authority.

For some of dis ogbonge players, dis be dia last tournament; odas go try one more time for di 2030 World Cup.

A few of dem go also try anoda shot for di African cup of nations for 2027.

List of players wey already announce dia retirement

Brazil were eliminated from the R16

Wia dis foto come from, ANGELA WEISS/AFP VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Neymar retire as Brazil's all-time top-scorer wit 80 goals from 130 games

Neymar

Di 34-year-old wey play only 38 minutes throughout di World Cup announce im retirement from international football afta dem comot di tournament for di R16.

Norway defeat Brazil 2-1 for dat game wit two goals from Erling Haaland bifor Neymar score late penalty for di 100th minute.

Dat penalty no dey enough, na so di Seleccao comot di competition – wit Neymar in tears.

"I bin try. I bin try. Now e dey ova. Na here is start for international football, na here I bin finish," Neymar tok for one interview for TV Globo afta Brazil comot di World Cup for di MetLife stadium.

Neymar play im first match for Brazil for dis stadium for August 2010; im also score for dat game wey end 2-0 against di US.

Di Santos forward since become di all-time top scorer for Brazil wit 80 goals from 130 games.

But injuries make Neymar no play for di national team since 2023 bifor dem select am for dis World Cup wit plenty controversy.

Neymar play for four world cup tournaments – 2014, 2018, 2022 and 2026

Guillermo Ochoa

guillermo has appeared at six world cups

Wia dis foto come from, MANUEL VELASQUEZ/FIFA/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Guillermo Ochoa na Mexican legend wey hang im boots both for di national team and professional football

Di 40-year-old goalkeeper na Mexican legend wey be di first choice since 2014 bifor im lose dat spot for di 2026 tournament.

Im already tok say dis World Cup na im last tournament for di national team bifor di competition even begin.

Im also tok say im dey hang im boots from professional football afta di World Cup

Na so dem make im play im final minutes as Mexico footballer for di game against Czechia for 25 June.

Dis na im sixth world cup (2006,2010,2014,201, 2022 and 2026) wey im play 12 minutes for di current competition bifor England comot dem for R16.

Ochoa no fit control im tears afta Mexico lose dat match.

"Azteca na wia I bin play my first game, na hia be my last game," Ochoa tok afta di game.

Im add say "dis na beautiful chapter for my career, I tank everybodi".

Di 40-year-old bin play 153 games for Mexico; 12 of dem na for di World Cup.

Manuel Neuer

Neuer retires after nearly 130 games

Wia dis foto come from, MICHAEL REAVES/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Manuel Neuer retire for 2024 but di German coach Julian Nagelsmann recall am for di 2026 World Cup

Di German goalkeeper wey help Germany win di 2014 World Cup for Brazil bin hang im boots from international duty for 2024.

For 2020, im win di Best Fifa World Goalkeeper – at di time im first retire, im chop 38 years.

But German coach Julian Nagelsmann bin recall di now 40-year-old Neuer from retirement for di 2026 World Cup as first-choice keeper.

Afta Germany bin comot di tournament on penalties to Paraguay, Neuer announce im retirement from international football for di second time.

"Di early exit from di World Cup dey disappointing, we neva reach di expectations of di kontri and di fans," di 40-year-old tok afta dem comot di tournament.

"I bin make conscious decision to play for Germany one more time sake of to dey wear di national team jersey na pride, wey I gat experience for four world cups na so I bin want support di young players."

Neuer add say "I don dey disappointed well well, but I dey grateful. Thank you for di support ova all dis years."

Di Bayern Munich goalkeeper bin play 128 games wit Germany since im debut for 2009.

Riyad Mahrez

the Algerian legend has played 119 games

Wia dis foto come from, ERCIN ERTURK/ANADOLU VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Mahrez win CAF Afcon player and BBC African player of di year for 2016

Afta 12 years, Algeria captain Riyad Mahrez don announce im retirement from international football.

Di ex-Manchester City star carry Algeria to di 2026 World Cup but dem lose to Switzerland for di R32.

Di 35-year-old bin score two goals for dis tournament but afta dia defeat to Switzerland im tok say dis na di end.

"I bin get good times and difficult times, but na part of di career," im tok afta di game.

"To represent Algeria na my dream since I be pickin; to play for my kontri. Na great honor and pride for me say I fit do am. Na di turn of di new generation now".

Mahrez bin dey retire as player for wit di second most appearances for Algeria history (119) wey im get di second most goal also (40).

Di Al Ahli forward bin dey part of di Algeria team wey win di 2019 Afcon.

For 2016, Mahrez win di CAF African footballer of di year, dat same year im also win BBC African footballer of di year.

Pape Gueye

senegal were eliminated by Belgium in a pulsating 3-2 R132 game

Wia dis foto come from, HARRY LANGER/DEFODI VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Pape Gueye bin score two goals for di World Cup but im say im dey quit Senegal unless dem change di coaching staff

Di Senegal midfielder announce say im dey quit international football after Belgium sama dem 3-2 for dia dramatic R32 game.

Senegal bin dey lead di game 2-0 till di 85th minute bifor dem allow Belgium to score two quick goals to carry di game enta extra time.

Yuri Tielemanns score di winning goal from di penalty spot afta VAR bin award dem penalty for di last minute for extra time.

Na so Gueye wey dey play for Villarreal for Spain tok say im dey quit.

"I go come back to say some tins about how we comot dis World Cup, but I dey tok am now say as long as dis same coaching staff dey di team, I go take break from di national team," di 27-year-old bin write on top im social media page.

Gueye play 45 games for Senegal wey im score two goals for dis World Cup bifor dem comot di competition.

Coach Pape Thiaw bin dey coach Senegal since 2024 wey im be one of di pipo wey make dem collect di Afcon from dia hand wey dem carry give Morocco sake of im call im players to comot di park for dat game afta di referee give di Atlas Lions late penalty.

E neva dey clear if dis decision by Pape Gueye to quit di national team go change any time soon, but di Villarreal midfielder make am clear say tins gatz change for di management of di national team.