Ghana vs Colombia World Cup Round of 32 match preview

Wia dis foto come from, BUDA MENDES/HECTOR VIVAS/FIFA VIA GETTY IMAGES
Six African teams don already comot from di World Cup, only Morocco qualify for di Round of 16 so far.
Di Black Stars of Ghana go try to become one of di few kontris to qualify but dem gatz jam wit South American team Colombia.
Tunisia, South Africa, Ivory Coast, Algeria, Senegal and DR Congo already comot di tournament.
Di only three – Egypt, Cape Verde and Ghana go try dia best to join di Atlas Lions of Morocco, but e no go dey easy.
Colombia na one of di best teams for di group stage for di tournament, dem sama DR Congo 1-0, dem also beat Uzbekistan 3-1 bifor dem play 0-0 draw wit Portugal.
In fact, na dem win Group K wit seven points.
For di three group stage games, dem score four goals, wey dem concede only one.
Ghana for di oda hand finish di group stage third wit four points – afta dem beat Panama 1-0 wey dem hold England to 0-0 draw bifor Croatia sama dem 2-1.
Di Black Stars of Ghana score only two goals from 11 total shots and four shots on target, La Tricolor bin play 42 shots,19 on target.
Colombia get plenti momentum ahead of dis match afta dia impressive 0-0 draw wit Portugal, in fact, dem nearly win dat game for di last minute but referee bin rule out dia goal for offside.
Di Black Stars go hope say dem go fit put up anoda defensive masterclass against some of di best attackers for di world for Saturday dawn.
Di two teams bin dey jam each oda for di first time eva, na so tins no really clear di gameplan both coaches wan use, but sabi pipo say Ghana go use dia defensive strategy to hope to prevent Luis Diaz, James Rodriguez, Luis Suarez and Juan Hernandez.
If Colombia bin win dis game, dem go qualify for di R16 of di competition for di fourth time.
Na so Ghana go qualify for R16 for di third time if dem sama Colombia.
Di last two meetings between Ghana and South American teams neva end well; Brazil comot di Black Stars for R16 for 2006 wia Uruguay comot di kontri wit penalties for di 2010 tournament for South Africa.
Colombia dia only World Cup knockout stage game wit African team na when dem lose 2-1 to Cameroon for 1990.
Whoever go win dis Ghana v Colombia game go qualify for di R16 to meet Switzerland for Vancouver on 7 July.
Wetin di coaches tok ahead of di game

Wia dis foto come from, HECTOR VIVA/FIFA VIA GETTY IMAGES
Colombia coach Nestor Lorenzo believe say im team fit beat Ghana for dis match but im say dem gatz dey alert for di full 90 minutes.
"Ghana be organised team but dem also be aggressive when dem dey press and when dem dey attack. Dem dey play very well wit some of dia players for Europe clubs."
Im add say "our own team get quality also; dem gatz dey versatile, to occupy di spaces and perform well for defense."
"I tink our team don grow for many aspect of di game, we hope say we go fit continue to grow."
Ghana coach Carlos Queiroz say im dey ready to see wetin di two teams go show for park.
"Na fantastic tin to see wetin di two ogbonge teams go show for park, wit dia different style. Both teams wan win dis match to create entertainment and try to get di best result."
Queiroz also tok say "Colombia na very good team but for dis world, no team dey perfect. Dem get weakness and some strengths, we gatz dey alert and careful throughout di 90 minutes."
Possible lineups for Ghana v Colombia
Colombia XI: Vargas (GK); Lucumi, S Arias, Puerta, Machado, Sanchez; Rodriguez, J Arias, Lerma; Diaz, Cordoba.
Ghana XI: Asare (GK); Adjetey, Mensah, Luckassen, Senaya; Owusu, Semenyo, Partey, Sibo; Ayew, Fatawu
Di game go happun Saturday dawn at 1:30 AM GMT (2:30 AM WAT) for di Kansas City Stadium for di USA.









