Former Lagos deputy govnor and Nigerian senator Idiat Adebule die at age 56

Woman open her mouth
Published
Read am in 4 mins

Di Lagos State Chapter of di All Progressives Congress (APC) don announce di death of former deputy govnor and senatorial candidate Idiat Adebule.

Adebule die at age 56, just less dan 48 hrs afta her birthday.

According to Seye Oladejo wey be Lagos State APC tok tok pesin, e say di party dey 'devastated' and shocked by di death of di former Lagos deputy govnor Senator representing Lagos West Senatorial District.

"Her passing naenormous loss to our party, Lagos State, di political community and di nation at large. E dey particularly painful becos e represent di untimely departure of a distinguished political leader, accomplished educationist, committed public servant and dependable party stalwart wey her life dey defined by service, dedication," di statement tok.

Dem born Adebule for 27 November 1970, and she don serve for different public offices, especially for Lagos.

'We dey devastated' - Lagos APC

APC say senator Adebule dey much more dan political office holder. Dem describe her woman of substance and uncommon political commitment.

"Her journey through public service, from her academic and administrative engagements to her tenure as Secretary to di Lagos State Govment, Deputy Governor between 2015 and 2019, and subsequently as Senator representing Lagos West, na remarkable record of dedication to di pipo and development of Lagos State."

For dia announcement, APC say senator Adebule na loyal, dependable and highly respected political leader wey her contributions to party organisation, no go dey forgotten.

"We dey particularly devastated by di suddenness of dis loss. E difficult to reconcile di reality of her departure wit di energy and commitment wey she use discharge her responsibilities and engage wit party members and constituents."

Nigerian president Tinubu mourn Senator Adebule

President Bola Tinubu don express shock and sadness ova di sudden passing of former Lagos State Deputy Govnor and incumbent Senator representing Lagos West, Senator Idiat Oluranti Adebule.

Tinubu say senator Adebule 'die afta brief illness for Lagos.'

"President Tinubu describe her death as painful loss not only to Lagos State and di National Assembly but to di nation as a whole, particularly at time wen her experience, commitment, and contributions to public service dey needed." statment by Bayo Onanuga tok.

President Tinubu praise di deceased political journey, wey 'reflect years of commitment to public administration, education, and empowering citizens, particularly women and di youth.'

Who be Idiat Adebule

Senator Idiat Oluranti Adebule na Nigerian educationist, writer, administrator, and politician.

She dey represent Lagos West Senatorial District for di Nigerian Senate.

She be member of di All Progressives Congress (APC) and she dey known for her previous position as Deputy Govnor of Lagos State.

Adebule begin her educational journey at Awori College, Ojo, Lagos State and she later proceed go Lagos State University (LASU), wia she obtain Bachelor of Arts for Education in Islamic Studies in 1992.

She earn master degree in Curriculum Studies in 1997 and a Doctor of Philosophy (PhD) in Curriculum Studies in 2012 for di same school.

Afta she complete her National Youth Service Corps (NYSC) programme for Bauchi State, she start to dey work as lecturer at di Lagos State College of Primary Education, Noforija, Epe, in 1995.

Adebule begin public service job for 2000 wen dem appoint her Commissioner I for Lagos State Post-Primary Teaching Service Commission (PP-TESCOM),

She later serve as member of di Lagos State Scholarship Board between February and November 2005, wia she dey involved in scholarship administration.

For July 2011, Govnor Babatunde Raji Fashola appoint her Secretary to di Lagos State Government (SSG). She become one of di key administrative officials for di state govment.

Her major political move come for 2015 wen she dey selected as di running mate to Akinwunmi Ambode, di All Progressives Congress govnorship candidate for Lagos State.

Dem win, and dem swear her in as Deputy Govnor of Lagos State on May 29, 2015. She serve for di position until May 29, 2019, afta she di sixth woman to occupy di office.

Afta she complete her tenure as deputy govnor, Adebule remain active for Lagos State politics and APC.

For 2023 general election, she contest for di Lagos West Senatorial seat and defeat her opponents to emerge as senator-elect.

She is di APC Lagos West Senatorial District candidate.