Domestic violence kill at least 50 women for Cameroon in just four months

Famous female Cameroonian football player Ajara Nchout Njoya of FC Internazionale

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Nchout Njoya Ajara, 33, na one of Cameroon most ogbonge female footballers and dey play professionally around di world
    • Author, Paul Njie
    • Reporting from, Yaoundé
  • Published
  • Read am in 3 mins

Di killing of at least eight women within one week don spark serious anger for Cameroon, as many pipo don begin call on di govment to do more to protect women and girls from violence and insecurity.

Among dos wey don speak out na popular Cameroonian footballer Nchout Njoya Ajara, wey don say make di "tragic wave" of attacks and killings wey dey target women stop, as she say "silence na agreement".

Di govment don also raise concern about di rise for di attacks. Dem don kill at least 50 women between January and April dis year, compared to di 77 e be last year, according to official figures.

Di latest case bin comot on Tuesday wen dem kill one 44-year-old woman for inside one hotel room for di capital, Yaoundé.

Na one 22-year-old allegedly stab her to deat, but dem later don arrest am.

Ajara wey be one of Cameroon top female footballers tok say, "to be woman for Cameroon no suppose ever be risk".

Di 33 year old striker don play professionally for Russia, Sweden, Norway, Spain, Italy and Saudi Arabia for clubs wey include Atlético Madrid and Inter Milan.

Ajara tok say, "for face of di tragic wave of femicides wey don hit our kontri in recent days, silence na complicity".

Di opposition Cameroon Renaissance Movement (CRM) party tok for statement say dem dey vex by di "tragic recurrence of domestic femicides" as dem dey accuse di govment say dem dey do anyhow about di mata.

Most of di femicide cases bin wey dey linked to domestic violence don dey reported from all ova di kontri.

Di minister for women empowerment and di family, Marie-Thérèse Abena Ondoa even comot for video wey state media bin release to condemn wetin she call di "worrying" rise in di number of killings, she say di govment dey work to address di wahala.

She tok about bill to protect women against gender-based violence, wey she tok say dey di prime minister dey review..

But civil society and women rights group don call out wetin dem see as govment delay to turn di bill to law.

One parliamentary session wey suppose to be di last of di year, suppose hold for November. But Viviane Tathi wey dia organisation dey torchlight cases of femicide for di kontri tell BBC say she no sure say di bill go dey passed for dat session.

She tok say, "we dey worried bicos November parliamentary session dey focus on budget debates... So, we no know which kain magic dis bill wan use take pass".

She don call make dem arrange special court wey go fit handle family wahala wey fit lead to domestic violence.

According to di newest UN data, Africa don get both di highest total number of di victims of femicide and di highest rate wen you link am to di population for 2024. E dey estimated say di continent don see estimated 22,600 cases.

Di numbers na estimate becos some cases of femicide dey thought say dem no dey report am and many govment no dey normally record di information.

The numbers are an estimate as some cases of femicide are believed to go unreported and many governments do not consistently record the information.