'Tap water no dey safe' - South Africa warn residents afta ova 400 fall sick

Pipo gada to find water
Published
Read am in 3 mins

Residents wey dey live near South Africa capital, Pretoria, don receive warning say make dem no drink or cook wit tap water.

Dis na afta more dan 400 pipo, mostly children under four, fall ill afta dem drink contaminated water.

Di cases dey detected for Tshwane, di area wey include Pretoria, afta pipo report to dia local hospital wit "stomach cramps and diarrhoea" ova two-week period, officials say.

No deaths dey reported yet but dem find high levels of E. coli for di water.

Tshwane don face numerous outbreaks from waterborne diseases in recent years. For 2023, 29 pipo kpai sake of cholera outbreak for di towns just outside Pretoria.

Water crisis in Hammanskraal

Dat outbreak for Hammanskraal, dey linked to substandard water purification practices.

For 2025, officials confam 48 cases of typhoid for di same area east of Pretoria. Di source of di outbreak still dey unclear.

Dem no find outbreak of cholera bacteria yet for di latest cases.

Di departments of water and health, for joint statement on Monday, say dem don find 408 cases between 7 and 18 October for about five townships.

Dem say lab tests "indicate say di illness dey caused by residents wey dey exposed to contaminated water" from local water treatment facility supplying water to several communities east of Pretoria.

Samples wey dem test find norovirus, campylobacter, shigella and "oda pathogens wey cause stomach cramps and diarrhoea", officials say.

Di team early investigations find say local authorities fail to warn residents about di contaminated water.

Di water supplied to di area don dey declared unfit for human consumption and authorities say make residents only use am to flush toilets.

Dem don dispatch tankers to supply clean drinking water.

"Previously stored water should be discarded, and water containers must be disinfected using household bleach," officials say.

Residents wait to get clean drinking water from tankers in Tshwane
Wetin we call dis foto, Tests found traces of E. coli in water supplied to residents living near Pretoria

South Africa health and water sanitation authorities investigating

Health and Water Sanitation authorities for South Africa dey investigate outbreak of diarrhea and oda gastrointestinal illnesses wey don alreadi affect at least 408 pipo for Bronkhorstspruit and surrounding communities, east of di capital, Pretoria.

Officials say most of di patients wey dem dey treat na under four years old children.

For Bronkhorstspruit Hospital na isolation area and overflow beds dey set-up to manage new infections.

Meanwhile govment team, wey include di minister of health, di minister or and don gada to handle di crisis alongside di municipal mayor.

Reporting by Khanyisile Ngcobo

Additional reporting by Pumza Fihlani