Another set of Nigerians go leave South Africa, Bianca-Ojukwu make last evacuation call

Bianca Odumegwu-Ojukwu

Wia dis foto come from, X/@Ojukwu_Bianca

Published
Read am in 5 mins

Nigeria dey expected to evacuate anoda set of Nigerians from South Africa go back home.

Di evacuation go happun on Tuesday for Johannesburg and arrive Lagos on Wednesday 8 June.

Dis dey come afta dem don comot about four sets of kontri pipo from di kontri afta anti-immigration protests wey don kpai two Nigerians bin start for di kontri.

Di protesters bin give migrants till di end of June but evacuation process still dey go on.

Nigeria report say dem dey target to comot about 700 kontri pipo for di next couple of evacuations.

But even on dat mata, di Federal Minister of Foreign Affairs, Bianca Odumegwu-Ojukwu don put deadline on di mata.

For statement wey she release on Monday, she reveal say, "Di last evacuation flights dey expected to land for South Africa for 10th July. Our Nationals dey again advised say make dem weigh di risk of weda dey go stay or return. "

She torchlight say, "for pipo wey dey siddon for fence, make dem remember say properties and investment lost fit dey replaces, but no be for lioves wey dey lost".

Dis dey come afta tori land say two kontri pipo bin kpai following di kasala.

African kontris wey don comot dia citizens from South Africa
Wetin we call dis foto, African kontris wey don comot dia citizens from South Africa

Madam Odumegwu-Ojukwu tok say, "Nigeria still dey worry ova di safety of dia kontri pipo for South Africa sake of di xenophobic protests and attacks of migrants and even more afta di deaths of two Nigerians, Musa Yunana Joe and Charles Iroegbu for dis palava events".

One statement from Nigeria foreign ministry tok say according to report, police officers for Tshwane Metro Police kill Emeka Charles Iroegbu for Pretoria on 28 June "using gruesome interrogation techniques".

Di second victim according to di Nigeria foreign ministry na Musa Yuana Joe, Alias Big Joe, wey unidentified attackers kill for front of im shop on di same day for Witibank, Mpumalanga.

She add say, "signs no dey say di situation dey improve".

Foto of some Nigerians wey recently return from South Africa sake of anti-migrants wahala

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria don so farrun four of dis evacuation trips for dia kontri pipo

Di 7 July evacuation go be di fifth one in series of flights of Nigerians from South Africa afta anti-immigration protests bin ginger across di kontri.

Di first batch of 258 pipo bin arrive Nigeria on 11 June 2026, while on 24 June, di second batch of 66 pipo arrive, and den on 30 June di third batch of 269 pipo arrive.

Di last set wey comot bin comot for 3 July and carry 266 pipo on board come back Nigeria.

Dis na even as protesters put ultimatum for ground dey ask for illegal immigrants to comot from di kontri bifor 30 June, 2026.

As e relate to lost properties and investments, di Foreign Affairs Ministry tell di BBC say dem go consider demand for compensation from di South African govment, for many Nigerians wey abandon dia valued property and livelihoods in order to save dia lives.

No be only Nigerians don kpai for dis kasala for South Africa.

Ghana Foreign Affairs Ministry confam say dem kill one 40-year-old Bashiru Isak iside shooting wey happun for Khayelitsha for Cape Town on 30 June, 2026.

Dis na even though South African police and di Ministry of Justice and Constitutional Development tok BBC say di killing happun a day bifor di protest, wey e neva dey connected to di anti-foreigners protests.

How di anti-immigration protestss take start for South Africa

South Africans dey protest immigration for di kotri

Wia dis foto come from, Getty Images

For 28 April, hundreds of anti-immigrant lobby group March and March movement, plus oda civil society organisations, enta di streets of Pretoria, one of di largest city wey be home to migrants for South Africa.

Dem march go di union buildings, di official seat of di govment to voice dia frustration ova illegal immigration.

Protesters say govment dey fail to prioritise di needs of South African citizens, dem accuse di govment of turning blind eye to growing concerns around crime and jobs.

Di demonstrators hold sometin wey be like sticks, wear March to March T-shirt and carry placards wey dem write "March and March until we win. If fighting for my kontri mean say I be xenophobic, den I'm proudly xenophobic".

Dem want make govment send di pipo wey dey di kontri illegally back home.

Businesses around di area bin close dia doors, as fear dey say di protest fit turn violent.

Di anti-migrant campaigners demonstration dey come afta series of xenophobic attacks on foreigners for di kontri.

Dis demonstration dey come afta one recent anti-foreigner attacks for di kontri wey lead to di death of some African nationals including two Nigerians.

Chairman Nigerian Union of South Africa Olaniyi Abodedele wey confam dia death to BBC News Pidgin tok say dem die for di same week wey anti-foreigner protests bin dey ginger.

E identify di pipo wey die as Kelvin Chidiebere Amaramuiro and Ekpenyong Andrew.

Explaining di circumstances wey surround dia death, Oga Abodedele say Andrew die on Sunday, 19 April for Pretoria West. E say officials bin arrest am, and no tell am wetin be im offence. E claim say dem beat am to death and dump im body for hospital.

For di second victim, Abodedele say according to reports wey im gada, police and di military invade Kelvin Amaramuiro house on Monday, 20 April, dem ask am to provide evidence of wetin e dey do.

"Dem beat am well-well and lock am for jail, and on Wednesday, 22 April, e get bail. E go hospital for treatment and e go back house feeling better. On Thursday, e go hospital again, only for dem to tell am say e get internal bleeding. Unfortunately, e die on Friday, 24 April."