More dan 800 still dey miss for Nepal as authorities say na glacial collapse trigger flash flood
- Author, Phanindra Dahal and Laura Bicker
- Reporting from, Kathmandu and Beijing
- Published
- Read am in 5 mins
More dan 800 pipo still dey miss for Nepal afta massive flash flood on di border wit Tibet.
Di flash flood bin wash away villages and destroy roads and infrastructure.
Rescuers don recova at least 165 pipo so far for Nepal, and rescue efforts dey complicated by rain and geography.
One man wey dem rescue wit helicopter say im wife still dey somwia under di mud.
For Tibet, at least 558 pipo still dey miss and dem don confam three pipo dead. E no clear if dis figure overlap wit Nepal own.
For both sides of di border, hundreds of foreign nationals still dey miss - Nepal say e include more dan 100 tourists from India, 54 from di US, and 33 from di UK and four from South Africa.
Di US Geological Survey say na "glacial collapse and debris flow" trigger di floods.
Di area dey popular wit pilgrims and trekkers.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nepal Prime Minister Balendra Shah say im dey left wit "heavy heart" afta di kontri fatal flash floods.
"Di whole nation dey shocked and deeply distressed" by di loss of life and damage to property, e tok for one social media post, as e call di disaster "sudden" and "massive".
Di flood happun for di early hours of Wednesday for Rasuwa, just north of Nepal capital Kathmandu.
Initial information suggest say na earthquake wey trigger one avalanche wit melted snow wey dey pour into di Bhote Koshi river cause am.

Wia dis foto come from, Shaktimaya Tamang

Wia dis foto come from, Reuters
Several areas downstream of di Bhote Koshi river, wey dey flow from Tibet to Nepal, dey on high alert and roads, communications and power for di region also dey affected. Authorities don close di main road to Kathmandu.
Verified videos from Nepal show as water carry one bridge comot and as multi-storey buildings collapse by di force of floodwaters - one town wey also get many buildings destroy.
BBC Verify don locate di clips to di town of Trishuli Bazaar area of Nuwakot District for Bagmati Province, about 25km (16 miles) to di north-west of Kathmandu.
Di video show as di river Trishuli suddenly swell by enormous amounts of water, wey appear to don significantly increase in volume and speed and filled wit sediment.
Di second verified video, wey dem feem from di same location, show di destruction. Di river level don rise well-well, and di water clear trees and many buildings wey dey visible for di earlier video.
One new video wey dem feem from inside one bus for Trishuli show as many pipo dey try run as flash flood rush down di valley.
Pipo fit hear as di passengers dey cry, as di bus drive along di road wey follow di river.
'Water carry my family members away... for front of my eyes'
Some survivors of di flash flood follow BBC tok.
"Flood sweep my family members away for front of my eyes," Kalpana Malla from Nepal Nuwakot district tok.
She say di flood clear her papa, mama, sister and her sister children away.
"Dem no fit escape di flood; no chance at all," she tok. "Dis flood take evritin except my son and I climb di rooftop of one house and survive but I no fit explain how."
Her son, Sugam Malla, say im pull im mama hand to save her.
Anoda woman, Goma Pandit, tok say she lose her buffaloes and all her oda cattle.
"My farmland don go. Ten sacks of mustard seeds, tons of corn and rice paddy evritin don go. Notin remain."
Nepal Army tok-tok pesin Rajarm Basnet tell BBC say efforts dey go on to rescue 115 pipo from di village of Mailung.
Nepalese Ministry of Home Affairs say huge loss of life go likely dey for Timure, Syabrubesi and Betrawati. Flooding don also cause damage to di Trishuli hydropwer project.
Di extent of di damage on di Tibetan side neva dey clear but BBC tok to Guan Daoxuan for Sichuan province wey tok say im lost contact wit im wife on Wednesday morning.
Nepal disaster management authority don ask pipo wey dey live near river banks for vulnerable areas to remain alert and take precautions.
Nepal Foreign Affairs minister Shishir Khanal tell parliament say 26 police personnel, nine armed police officers and 44 members of di military dey miss.
E say earthquake at 08:37 local time bin trigger avalanche and preliminary information say na wetin cause di flash flood.
Rasuwa bin see deadly flooding last year wey kill 18 pipo afta glacier burst on di Chinese side of di border.















