'Dem bin don attack me inside taxi, I run comot leave my phone and evritin' - Nigerian wey escape attack for South Africa

Di first flight wey dey carry di 270 Nigerians wey dey comot from South Africa leave Johannesburg, South Africa on Thursday morning.
Afta di flight bin experience delay, dem finally leave South Africa early morning.
Di 270 pipo dey part of di around 1000 pipo wey di Nigerian consulate say dem register to return to Nigeria.
Dis Nigeria citizens dey return sake of di protests and attacks on illegal migrants wey don dey happun for weeks across South Africa.
Oda kontris like Ghana, Zimbabwe, Malawi and Mozambique don carry some of dia citizens comot from South Africa.
Last Sunday, South Africa President Cyril Ramaphosa tok say South Africa no dey xenophobic and immigrants no be di cause of di economic situation and unemployment for di kontri.
'Dem bin don attack me inside taxi, I run comot leave my phone and evritin'
Meanwhile for di Johannesburg or Tambo airport, Justin wey be one of di passengers wey dey return to Nigeria tell di BBC say im don live for South Africa since 1998 and im dey comot sake of fear make dem no kill am.
"I dey comot becos of di conditions wey dem don give us for hia. Dem tok say we must comot on or bifor 30th June. And becos of di way wey dem dey kill pipo, our brodas, so I no dey safe."
Im bin dey refer to di unofficial deadline wey some of di protesters wey dey protest against all undocumented migrants to leave South Africa give.
Dis deadline don put fear inside di migrant communities wey dey worry say if dem kontinu to say katakata fit happun wey fit cause kasala on di deadline day.
Justin tok say dem bin don already attack am bifor.
"Recently dem bin already attack me inside taxi. I run comot and I leave my tins run away. I leave my phone and evritin."
Im tok say dem bin attack am sake of say im be Nigerian.
"Dem call us name and say You must leave dis kontri. Wen we bin try to beg dem, dem start to insult us.
No official figures about di number of deaths wey di xenophobic kasala don cause in recent weeks.
Di police say two Mozambican men kpai for di western cape earlier dis month but dem no given any motive.
Di Mozambican authorities say more of dia kontri pipo kpai and dem beliv say na sake of di xenophobic violence.
Some of di protesters don blame illegal migrants for di high rate of unemployment for South Africa wey dem estimate to dey between 30 and 40%.
Dem also say migrants dey put pressure on public services like schools and hospitals. But Nigeria Consul General for South Africa, Ninikanwa Okey-Uche tell di BBC say dem no suppose blame migrants.
"Di percentage of migrants for South Africa dey like 7 to 8% around dat. Den no be, and no fit be di problem. So, dem dey use migrants as basically di scapegoats. Dem no go fit blame 7 to 8% of a population for broken systems for education, health care, policing, unemployment."
She add say many migrants end up as undocumented even though den bin give dem valid visas and say make pipo avoid to generalise di whole population becos of di actions of few pipo.
"As a Nigerian and as di Consul General, one of di tins wey we really, really get para about na wen Nigerians are generalised. You get only few pipo wey dey involved in crime, and den you paint evrione with di same brush. But in di same way we no wan to dey generalised, I dey also tell my pipo, make dem no generalise South Africans. Di South Africans wey dey do all dis xenophobia na still small percentage."
Ova di weekend President Cyril Ramaphosa bin give address as e respond to di protests. Im bin announce new measures to crackdown on illegal migration.
Dis measures include jailing employers wey dey hire undocumented workers, dem dey set up dedicated courts to speed up di deportations and to get a biometric database for evrione for di kontri to avoid identity tiff-tiff.
Im also warn South Africans make dem no take di law into dia own hands by targeting di pipo wey dem dey suspect say dem enta di kontri illegally.
But Mrs Okey-Uche say di South African authorities need to do more.
"For a long time, dem don tok di right tins at di top. Plenti top South African politicians dey wey bin don speak up against wetin dey happun. Dem bin tok say e dey absolutely wrong. But down for di street, we need to see arrests. We know di pipo wey dey in charge, dem no dey hide.
Dem don cause katakata for many pipo life, but dem dey waka free, some of dem dey run for election. So, at di end of di day, we respect di president and wetin im tok, but we want to see clear action against pipo wey dey do dis xenophobic attacks and anti-foreigner sentiments."









