Trump say ceasefire wit Iran 'don over' afta US and Iran fire strikes overnight

Wia dis foto come from, Win McNamee/Getty Images
US President Donald Trum don declare say di ceasefire agreement between Iran and US dey "ova".
E tok dis one give tori pipo for di Nato Summit, e say "I no wan deal wit dem again, dem be scum".
E add say "as far as I dey concerned, e dey ova. Na just waste of time to deal wit dem".
Trump say di negotiators from both sides fit kontinu to tok "but I tink dem dey waste dia time."
Dis na as Iran don annouce say dem dey target American military sites for Bahrain and Kuwait, dis na in response to US strikes on dozen of Iranian targets.
US Central Command (Centcom) tok on Tuesday say dem don sama more dan 80 targets wey include ova 60 Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) small boats.
Iranian state media tok say di strikes bin hit areas like Bandar Abbas and Sirik wia sharpnel injure some pipo for dia.
Dis dey come afta attacks on three oil tankers for di Strait of Hormuz wey Iran no claim responsibility for.
Di Nato oga Mark Rutte bin call di US strikes "absolutely necessary" as im accuse Iran say dem dey "basically violate di ceasefire" wit "ships wey dey attacked".
Iran parliamentary speaker Mohammad Bagher Ghalibaf tok say na US wey breach di so-called memorandum of understanding (MoU) by say dem, "violate Iranian adjustments for di Strait".
Na last month, Tehnran and Washington bin sign one 14-page MoU, wey bin dey to increase di ceasefire and end di kasala "on all fronts".
Meanwhile for di kontris wey dem dey strike, dem don dey match leg for groud.
On Wendesday morning, tori comot of alarms wey dey sound for Bahrain.
Dis na as di IRGC say "di naval and aerospace forces of di Islamic Revolutionary Guard Corps for collabo missile and drone operation sama 85 key American military installations for Salman Port wey be di US Fifth Fleet area in Bahrain".
Di Iranian military also tok say e don target di Ali Al Salen Air Base for Kuwait.
In response di Kuwait foreing ministry don condemn wetin dem call di "repeated heinous Iranian aggressions".
For statement, dem tok say dis "brazen aggressions" dey go against efforts to reduce tensions and strikes "for tine wey regional and international efforts aimed for de-escalation dey go on".
Di foreign ministry tok say Kuwait get right to do evritin necessary to protect dia security.
How dis mata don affect oil price
Oil prices don jump up by more dan three percent following di strikes. Di international benchmark wey be barrel of Brent Crude don climb to $76.
Dis na di prices wey bin drop to pre war times afta di US Iran truce agreement last month.
But dis fresh attacks don start to dey fear pipo about di flow of traffic through di Strait of Hormuz wey normally dem see like a fifth of all di world oil dey pass through am.
No be only new strikes US dey sama Iran, dem don aso comot di temorary autorisation of Iran oil sales.
Dis authrosation bin dey for di MoU dem sign last month wey lallow for di sale of Iran cride oil, petrochemical nad petroleum priducts till 21 August. Na documents from di US Treasury on Tuesday confam say dem don sama di restrictions back.









