Kenya go bicom first African kontri to host World Athletics Championships - how dem dey prepare for 2029 edition?

Wia dis foto come from, Getty Images
Kenya go bicom di first African kontri to host di World Athletics Championships afta dem win di bid for di 2029 edition.
Dem beat London to win di bid. Di capital Nairobi go hold di event for di 48,000-capacity Kasarani Stadium.
London and Rome na di cities wey miss out, as Munich dey awarded hosting rights for 2031.
Kenya rich athletics heritage bin dey central to dia bid for 2029, as di East African nation boast of 72 World Championships and 38 Olympic gold medals, majorly for middle- and long-distance running.
Di East African kontri na di second-most successful nation for di history of di World Championships, and two-time Olympic marathon champion Eliud Kipchoge, wey also win 5000m gold for di 2003 World Championships, dey among di pipo wey make case for Nairobi during di bid process.
World Athletics president Sebastian Coe bin describe Kenya bid as "compelling and emotional".
"Kenya na one of di great athletics nations," Coe add.
"Dem weave di sport into di fabric of dat nation, di sport dey dia blood".
End of Di one wey oda users dey read well well
"E dey important for di World Championships to come to Africa wen we get di right host, di right bid and di right circumstances. Nairobi don demonstrate emphatically say dis na dia moment."
Di decision to award di event to Nairobi dey historic for Africa, as di continent neva host any senior World Championships even though dem don produce some of di sport biggest stars.
Kenya bid also highlight dia experience of hosting major athletics events, wey include di 2017 World Under-18 and 2021 World U20 Championships for Nairobi and di 2007 World Cross Country Championships for Mombasa.
Kenya dey prepare for di games

Wia dis foto come from, President William Ruto/X
Kenya bin don bid bifor now to stage di 2025 World Championships but lose out to Tokyo, sake of lack of infrastructure.
Dis time, di kontri bin point to upgrades wey dem don make on existing facilities as evidence of dia readiness.
Kenya don dey renovate dia stadiums for next year Africa Cup of Nations wey dem go co-host alongside Tanzania and Uganda.
Kasarani Stadium dey undergo complete structural overhaul for di build-up to hosting games for di continent biggest football tournament.
President William Ruto say dem dey invest for modern sports infrastructure across di kontri to nurture talent, create opportunities for young pipo and strengthen Kenya position as competitive sporting nation.
Kontris wey don host di games plus future hosts
Fifteen kontris don host di World Athletics Championships from 1983 to 2025. China, Kenya and Germany go host for 2027, 2029 and 2031 respectively.
Host kontris by year:
- 1983, 2005: Finland (Helsinki)
- 1987: Italy (Rome)
- 1991, 2007, 2025: Japan (Tokyo, Osaka)
- 1993, 2009: Germany (Stuttgart, Berlin)
- 1995: Sweden (Gothenburg)
- 1997: Greece (Athens)
- 1999: Spain (Seville)
- 2001: Canada (Edmonton)
- 2003: France (Paris)
- 2011: South Korea (Daegu)
- 2013: Russia (Moscow)
- 2015, 2027: China (Beijing)
- 2017: Great Britain (London)
- 2019: Qatar (Doha)
- 2022: United States (Eugene)
- 2023: Hungary (Budapest)
- 2029: Kenya (Nairobi)
- 2031: Germany (Munich)













