Lionel Messi father Jorge Messi die at age 68 afta long sickness

Former Barcelona football star Lionel Messi and im father Jorge Horacio Messi bin arrive di courthouse on June 2, 2016 for Barcelona, wia Messi and im father bin dey face di judges for tax fraud case.

Wia dis foto come from, LLUIS GENE/AFP via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Former Barcelona football star Lionel Messi and im father Jorge Horacio Messi bin arrive di courthouse on June 2, 2016 for Barcelona, wia Messi and im father bin dey face di judges for tax fraud case.
Published
Read am in 5 mins

Argentina forward, Lionel Messi papa wey be Jorge Messi don die at di age of 68.

E die on Saturday for hospital wey dey for central Argentina city of Rosario.

Atlético Newell's Old Boys, di club wey dey base for Rosario announce di death of Messi papa for dia social media post.

For di post di club announce say im bin dey receive treatment for sickness wey dem no call di name.

Di post describe Messi father as "di pillar and di pesin wey, wit vision, rigor and affection, support di career of di best player of all time, alongside im wife, Celia Cuccittini."

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Di South American Football Confederation, CONMEBOL, for statement also send dia condolence message "wit respect and affection for Lionel."

Lionel Messi lead Argentina to finish second for di 2026 World Cup.

For di first match, against Algeria, Messi bin dey emotional afta e score di first of im three goals. Im later tok say im bin dey cry wept for "a reason wey no dey related to sports."

AP reports quote Lionel Messi for dis tori say "I bin dey go through some difficult, complicated days," im tok. "I dey grateful to di group, to all my teammates, becos dem bin dey always by my side dey wish me strength so dat I go dey OK."

Media reports dat time bin make di Messi family para, but days later dem bin release statement wey confam say "Jorge dey sick" but dem no tok di kain sickness and condition wey im bin dey.

"Pesin health and di peace of mind of dia loved ones no suppose be di subject of speculation or irresponsible media interest," according to di statement, wey bin also express "discomfort for di lack of sensitivity, respect and amebo as pipo dey chook mouth for strictly private and family matter." Di family bin tok for statement.

Afta speculation about im health during dis summer World Cup, di Messi family bin issue one statement wia dem say e dey deal wit one "health-related situation" but dem no disclose di nature of im condition.

Jorge help im son to bicom arguably di best player of all time and bin dey Qatar to see Lionel end im quest to lead Argentina to dia third World Cup triumph for 2022.

Di 39-year-old Inter Miami forward, also bicom eight-time Ballon d'Or winner and e win di Champions League four time with Barcelona, plus 10 La Liga titles for 17 seasons for dia first team.

Jorge bin support im local team Newell Old Boys and Lionel join di club wen e be seven years old.

Di family bin relocate go Spain for February 2001 afta Barca sign Lionel wen e just be 13, and although Messi mother and three siblings soon move back to Rosario, im father stay wit am for Barcelona.

"Jorge na di pillar and di pesin wey support wit vision, rigor and affection di career of di greatest player of all time alongside im wife, Celia Cuccittini," Newell Old Boys post on X., external

"Im constant companionship and behind-di-scenes leadership bin dey essential in backing evri step of Lionel, from wen e start for Malvinas [youth academy] to di pinnacle of world football glory.

"Thank you for teaching him to love these colours."

Di club add say dem "embrace wit affection Celia, Lionel, Rodrigo, Matias and Maria Sol, plus all dia loved ones and close ones for dis difficult moment".

Di Argentine Football Association say dem "deeply mourn wit sadness and sorrow di passing of Jorge Messi, father of our captain and emblem, Lionel Messi".

Dem add say: "From here, we stand in solidarity wit di entire family during dis difficult time and send di most heartfelt, warm and affectionate embrace."

Di Messi family bin respond afta one Argentine television presenter bin falsely report say Jorge bin die during Argentina opening game for dis summer World Cup.

Di presenter later resign as di family express dia "deep discomfort wit di lack of sensitivity, respect and discretion wit which some pipo take dey treat wetin be strictly private family matter".

Jorge Messi profile

Jorge Messi na chemical technician and im bin work as steelworker. Im bin play football as a midfielder and reach di youth ranks of Newell's Old Boys.

Im later abandon di sport to complete im compulsory military service for Argentina.

Im bin play important role for im third son career, as im serve as im agent and manage im business affairs.

Na im bin travel wit Messi wen Messi bin dey young to Barcelona for di early 2000s for di trial wey open di doors to La Masia, di Catalan club youth academy.

Lionel Messi play im first professional match for 2005 and im go on to win eight Ballon d'Or awards.

Messi also lead Argentina to di 2022 World Cup title.

According to AP report, wey quote Radio del Plata, for one of Lionel Messi interview for 2007 Messi tok say "My papa dey always by my side,"

"Sometimes I go lock myself inside my room to cry wen we arrive Barcelona, or my dad go do di same wen I no dey see am, or wen im tink say I no see am. We dey pretend say two of us dey OK, but we bin no dey OK. My dad go even ask me wetin i wan do wen we bin dey feel down, weda I wan stay or go back, and I bin wan stay, so im bin stay wit me."

Lionel Messi papa negotiate im contracts wit Barça and later im transfers to Paris Saint-Germain and Inter Miami.

Im bin dey also manage di use of im popular son image rights and all im plenti investments in real estate, hotels, and restaurants.

For 2016, Spanish Courts bin convict both Lionel Messi and im father sake of tax evasion charges, but dem bin avoid prison becos di sentence bin dey less dan two years.