Storms across US ground airlines, leave thousands without power on Thanksgiving holiday
- Author, Ana Faguy
- Author, James FitzGerald
- Author, Sareen Habeshian
- Published
- Read am in 1 mins
Authorities don cancel thousands of flights across di US as Thanksgiving storms batter parts di kontri.
More dan 80 million Americans dey expected to travel dis week at di same time di National Weather Service (NWS) don forecast storms along di western and eastern coasts of di US wey fit bring heavy rain and flooding.
US tracking site FlightAware tok say dem don cancel nearly 400 flights so far on Thursday, 26 November, for one of di busiest travel days of di year, and more dan 600,000 customers dey without power.
On Wednesday, FlightAware report more dan 6,800 delays and more dan 160 cancellations.
Di FAA bin previously warn say delays across di kontri go dey possible "throughout di week" sake of rain and wind wey dem forecast.
Ahead of di expected severe weather for New Jersey, di state govnor, Mikie Sherrill, declare state of emergency.
For New York City, organisers of di annual Macy Thanksgiving parade don postpone di event to Saturday.
Across di US, severe weather also dey descend on di West Coast. Di NWS bin don warn of series of Pacific storms wey dey expected to bring rain, mountain snow and strong winds.
End of Di one wey oda users dey read well well























