US announce new tariff proposals on 14 countries

Wia dis foto come from, Getty Images
Di United States don announce new tariffs on some of dia biggest trade partners wey include China and di European Union.
Di new taxes wey dem charge on imports to America go hit many of di kontri biggest trading partners, wey include China, di European Union plus 12 oda jurisdictions.
Di move dey come afta White House investigation into di trade practices of oda countries for March afta US Supreme Court rule say Trump previously announced Liberation Day tariffs dey illegal.
China dey face di highest rate of "up to 40%", followed by Vietnam wey dey up to 35% and oda countries dey face either 20% or 25%.
Di new duties no dey expected to take effect until next year.
Tariffs na taxes wey govment dey put on top goods wey companies import from abroad.
Dem dey usually calculate di amount wey importer go pay as percentage of di value of di goods, and na di businesses wey dey bring di products enta di kontri dey pay am to di govment.
Some of dis tariff rates go effectively reduce becos of tariff caps wey Donald Trump don agree to.
Different countries also dey face different tariff charges depending on di agreement and policy wey apply to dem.
List of countries wey dey affected
Di list of countries wey di proposed tariffs go affect include:
- China
- Di European Union
- Singapore
- Switzerland
- Indonesia
- Malaysia
- Cambodia
- Thailand
- Korea
- Vietnam
- Taiwan
- Bangladesh
- Japan
- India
Why US impose di new tariffs
Jamieson Greer, United States trade representative, tok say di latest tariffs wey dem issue go "level di playing field for American workers and chart a new, more sustainable course for di world economy".
E claim say many of America trading partners "for decades" don adopt industrial strategies wey include "targeting manufacturing, wage and labour suppression" as well as "oda market distorting practices wey dey distort market and make trade favour dem while e dey weaken America manufacturing sector.
But economists don warn say tariffs fit make inflation rise and push prices of goods higher for consumers if businesses transfer di extra costs give customers. Dem also warn say di tariffs fit slow down global trade and affect economic growth.
Dis no go be di first time wey Donald Trump dey run sometin like dis.
For April last year, Donald Trump reveal sweeping tariffs for global trading partners wit im presidentialemergency powers.
Tori be say many of dis tariffs, Supreme Court quick block am.
So, dis new import taxes wey dem announce on Wendnesday na new effort to put back Trump tariffs.
But im administration dey take anoda approach which mean say e go ikely tanda wen legal wahala wan come push. Dis na according to trade sabi pesin, Jayant Menon from di ISEAS-Yusof Ishak Institute.
Meno says, dis new rates go apply to fewer jurisdiction dey lower and more uniform dan di ones of last year.
Dem also dey based on months long investifation wey di White House commission to di labour and trade practices wey dis territories dey use and hoe dem fit affect di US.


















