Inec say dem go investigate as Nigerians raise alarm ova alleged AI-generated images of voters ontop dia website

Wia dis foto come from, Inec/X
Di Independent National Electoral Commission (Inec) through dia tok-tok pesin Mohammed Kudu Haruna say dem go investigate di alleged AI-generated images of voters ontop dia website.
Nigerians enta social media to allege say voters register wey Inec release dis week get AI-generated images of electorate.
Dem also claim say di list miss some names and odas claim say e double dia names. Inec neva respond to dis two claims.
Dis na as Inec release di first online list on Monday afta dem drop am for dia office.
BBC News Pidgin check di website and see profiles of voters wit images. But we no fit independently verify say na AI-generated images.
Inec tok-tok pesin Mohammed Kudu Haruna tell BBC say dem go investigate di mata.
E say, "For di pipo wey tok say dem see AI, I go go meet pipo for di technical department and tell dem wetin you tok.
"First of all, we gatz verify say true-true na AI pictures dey our records and secondly, dem go tell me how dat one happun bifor I carry di informate come give una."
Professor Pat Utomi, wey be one of Inec critics ontop of di mata of voters register tok say make di electoral joinbodi no dey carry trust for electoral process dey play.
"Di discovery of AI generated images of pipo for di 2027 voter registration come out wit questions about di truth and integrity of di elections," Pat Utomi tok for X.
For earlier statement, Inec say na bicos pipo bin ask about am, na im make dem release di list ontop dia website.
For di statement, wey dia tok-tok pesin Mohammed Kudu Haruna sign, dem add say, "dis na why we dey give evribodi di opportunity to go our website to see di names of dose wey go vote".
Wetin be di law about Inec voters list?
Section 19(5) of di Electoral Act say: Official or staff of di Commission, wey fail to display or publish di voters register as provided under subsection (1), e don commit offence and e dey liable on conviction to fine of 100,000 naira or imprisonment for a term of six months or both.
E say: "Di Commission gatz, not later dan 90 days to a general election, appoint a period of seven days during which a copy of di voters register for each Local Govment, Area Council or Ward gatz dey displayed or published for public scrutiny for evri registration area and for dia official website or any website established by di Commission for dat purpose."



















