Wetin cause fuel shortage wey hit Sierra Leone

Wia dis foto come from, SANOGO / AFP via Getty Images
Serious fuel shortage don hit Sierra Leone, wit long queues wey don form for fuel stations for di capital, Freetown, and oda parts of di kontri.
Di govment don blame di situation on shortage of foreign exchange, wey don delay payment for fuel shipments.
Fuel dey normally imported in US dollars and dem go sell am in leones, di local currency.
But di dollar shortage don lead to long queues and frustration among motorists, wey dey share dia frustrations wit pictures for online.
One resident, wey say make we no name am tell di BBC say motorists don pay twice di pump price.
E say e first notice di shortage last Thursday.
"All ova di city na queues and you see pipo wit jerrycans in desperate search of fuel. Black market dey now dey trend as pipo pay almost twice per litre."
"If you no dey connected or no know di owner of a fuel station, you no go get any drop in your tank," e add.
Osman Sesay, one resident of Freetown, tell di BBC say travellers dey stranded.
"Dis creates lot of inconveniences becos most pipo dey struggle for transportation. Wen we get dis fuel scarcity, pipo go get dia basic commodities from marketplaces and those going to work are facing a lot of challenges," e say.
Di Ministry of Information and Civic Education tok for one statement on Tuesday say dem dey work to bring the situation under control and say fuel prices no go increase dis year.
"Govment dey work closely wit relevant financial institutions, di National Petroleum Regulatory Authority and oil marketing companies to improve access to foreign exchange and make payments for fuel imports easier."
For 2022, increase for fuel prices na one of di major reasons behind one major protest over cost of living, wey lead to di death of 21 pipo and six police officers for Sierra Leone.















