Nigeria Super Eagles go face Guinea Bissau for Afcon qualifier today

Di Djurtus of Guinea-Bissau and di Super Eagles
Wetin we call dis foto, Di Djurtus of Guinea-Bissau and di Super Eagles
Published
Read am in 3 mins

Nigeria Super Eagles go face dia Guinea-Bissau counterparts for dia second Africa Cup of Nations qualifying match today.

Di match go happen for Bissau as di Djurtus dey home while di Super Eagles dey away game. Game time na 5pm Nigeria time.

Dis na Nigeria second qualifier after dem beat Madagascar 2-1 for Uyo for di last game.

Guinea-Bissau also win dia first match against Tanzania by 2-1.

Guinea dey top di Group L table with three points while Nigeria dey second with three points too but one goal against dem.

Madagascar and Tanzania loose dia first matches and dey occupy di third and fourth positions for di table.

Nigeria Super Eagles play di first match without striker Victor Osimhen wey get injury. Him no go still dey available for today match, dis mean say coach Eric Chelle go rely on oda strikers to deliver today match. New comer George Ilenikhena and Moses Osor score on dia debute to give Nigeria Super Eagles di three points.

Strikers Adams Akor and Taiwo Awoniy plus Dare Arokondare na di oda strikers wey dey ground wey fit filling in and help di Eagles.

Di Eagles struggle from one goal down to win di match at 2-1, after Madagascar score on di 16th minute of di game.

For di Djurtus of Guinea-Bussau, dem no too get possession against Tanzania but dem win di game by 2-0.

Star player Mama Balde still dey di team. Na him score for di 1-0 win wey Guinea beat Nigeria for AFCON qualifier for Abuja for 2023.

Balde score against Tanzania last Friday for dia first AFCON qualifier.

Dem go depend more on di experience of Beto and Balde to force a win against di Eagles.

Di team been done loose dia last four matches before di win on Friday.

However, di team don qualify for three consecutive AFCON tournaments before dem fail to qualify for di 2025 edition.

Dia coach Emiliano Te team get strong attacking force wey fit do unheard any time.

Head to head

Both teams don meet for senior level four times since 2022. Nigeria win three times while Guinea win once.

Di team been get only 31 percent possession wen dem beat di Super Eagles for Abuja. On Friday dem get di lasser possession but still beat Tanzania.

A win for either of di teams go move di team to number one position for di table. Draw go keep both teams on same points, but Nigeria go remain on second position.

Di team wey win maximum points for di group go qualify straight from di group.

'Meanwhile Tanzaia wey dey last for di group L don already qualify for AFCON 2027 as dem be one of di hosts of di tournament.

Dis mean say di remaining three teams go push to win and top di group table for dem to qualify.

Di 2027 African Cup of Nations AFCON go hold for Tanzania, Kenya and Uganda for January