Nigeria beat Madagascar 2-1 as dem begin Afcon 2027 qualifier

Nigeria senior national football team inside group photograph wit dia national jersey.
Wetin we call dis foto, Nigeria Super Eagles pose for foto bifor dia Africa Cup of Nations Group C football match between Nigeria and Tanzania for di Fez Stadium for Fes on December 23, 2025.
Published
Read am in 5 mins

Nigeria Super Eagles beat di Berea of Madagascar 2-1 to get all three point against dia opponent.

Di Super Eagle come from behind to beat Madagascar on home soil for di Godswill Akpabio International Stadium for Uyo.

Madagascar put pressure on di three-time African Champions. Madagascar score for di 16th minute through Eshan Kari.

Nigeria begin struggle but dem later get breakthrough afta first timer George Ilenikena score im first goal for im first match for Super Eagles for added time of first half.

Nigeria score dia second goal through Moses Usor wey score for di 67th minute to give Nigeria di lead and winning goal.

Madagascar too bin get beta chances dem troway two one-on-one chances and oda beta chances wey dem create.

Second Half

Full Time Nigeria 2-1 Madagascar

90+4' Madagascar dey on dia last attack but referee don blow whistle as match nd.

90+3' Nigeria Coach Eric Chelle dey give di players instructions from di sideline as di match remain few minutes to end.

90+1' Alex Iwobi strike di ball wey Moses Simon pass give am but e go out of target. 90' Referee add 4 minutes

89' Nigeria run deep into Madagascar goal area but defenders no allow Simon Moses play freely, two defenders bloack am untill dem comot ball from im leg.

87' Substitution for Nigeria Ola Aina don comot and Bright Osayi Samuel don enta.

85' Freekick for Nigeria afta Madagascar foul Moses Simon but Madagascar defenders clear di ball.

81' Moses Simon get anoda chance to score but e waste time small and di Madagascar goalkeeper run comeout to cach di ball.

77' Nigeria dey haold di ball well as dem dey find chance to score more goals but Madagascar goalkeeper no wann give dem space.

74' MISS! Arokodare of Nigeria miss chance to increase Nigeria tally, e play di ball well but im shot hit bar!

71' Madagascar player dey down and dem dey substitution too.

69' Substitution for Nigeria George Ilikiena don comot and Taiwo Awoniyi don enta

67' Nigeria 2-1 Madagascar

67' GOALLLLLLLLLLL FOR Nigeria Moses Usor score Nigeria second goal.

Corner kick for Madagascar dem play am but Nigeria defender clear i threar61'. Substitution for Nigeria Akor Adams abd Samuel Chukwueze don comot Moses and Moses Simon don enta.

60' Nigeria bin dey attack Madagascar dem don almost near goalpost but Madagascar player tiff di ball to end di build up.

57' YELLOW CARD for Nigeria as Ademola Lookman foul Mdagascar player wey dey ground dey receive treatment.

55' Nigeria just dey miss opportunities, di latest na Ademo0la Lookman wey play di ball over di bar!

53' Nigeria Akar Adam miss chance again as e play di ball go over!

51' MISS! Madagascar miss beta chance to take di lead, di player get one-on-one chance wit Nigeria goalkeeper Stanleyb nwabli but e miss di chance as Stanley 54' Macolect di ball.

48' Ademola Lookman of Nigeria play one weak pass wey go to di side of di goal post, e win corner for Nigeria but notin come out.

47' Calvin Bassey of Nigeria tackle Madagascar player wey frall for grow but Bassey do like say notin happun.

46' Referee blow whistle second half don start

45+ 3 First Half don end

45+1' Nigeria 1-1 Madagascar

45+1' GOALLLLLLLL FOR NIGERIA ! George Ilikiena score for Nigeria. Na im first goal for im ffirst match for di Super Eagles.

43' MISS! Nigeria miss chance to draw level wit Madagascar afta George Ilikiena play di one -on -one chnace enta di Madagascar goalkeeper laps.

40' Madagascar ne4va let Nigeria enta dia goaal area well as dia goalkeepr deyb catch anytin wey near di goal post.

35' YELLOW CARD for Madagascar player sake of time wasting.

30' Nigeria just dey fire Madagascar back to back wit shots and near misses for di last one minute but all di attempts neva enta net.

29' Onyeamachi of Nigeria pass di ball to Akor Adams bue bin dey offside,.

27' Chance for Nigeria as Chukwueze pass di ball to Ndidi but Nidid use e left leg play di ball wey roll go side of di goal post.

26' Samuel Chukwueze dribble two Mdagascar players , e konpass di ball to Onyemaechi but e play di ball go left side of di post.

25' Madagascar Captain Rayan fire beta shot bue e miss target and Nwabali waka go collect di ball.

22' Nigeria don wake up from sleep as dem begin attack by Madagascar no give dem space.

18' Madagascar take di lead as Nigeria dey in shock.

Nigeria 0-1 Madagascar

16' GOALLLLLLLL FOR MADAGASCAR Eshan Kari score di goal wit free head as Nigeria goalkeeper Stanley Nwabali raise handup in suprise

14' Madagascar don comeout, di player runwit di ball from midfield until e fire shot for Nigeria goal area>

12' Action neva too dey like dat but Nigeria SuperEagles dey pass di ball well but e don end for Madagascar golakeeper hand afta Chukwueze bin try to score.

8' CHANCE! Samuel Chukwueze of Nigeria nearly score but Madagascar goalkeeper come out to catch di ball.

4' Madagascar don manage hold di ball for di match , dem dey run go Nigeria defence area but no chance.

4' Wilfred Ndidi nod di ball go corner kick but notin comeout.

3' Few minute into di match, Nigeria dey hold ball, dem get one chance wey dem for convert but Ola Aina delay to pass di ball.

1' Referee blow whistle, match don start

First Half

Line ups

Nigeria starting 11:Stanley Nwabali, Ola Aina, Onyemachi, Ajayi, Ndidi, Lookman, Ilenikena, Chukwueze, Iwobi Bassey, Adams

Madagascar starting 11:Geirdan Dupire, Sandro Tremoulet, Jean-Pierre Morgan, Ehsan Kari, Rayan Raveloson, Marco IIaimaharitra, Clement Couturier, Mathieu Acapandie, Ryan Ponti, Hakim Abdallah, El Hadary Raheriniaina