Africa CDC confam fresh outbreak of Ebola for DR Congo wey don kill 65 pipo

Wia dis foto come from, Nicholas Kajoba/Anadolu Agency via Getty Images
Di Africa Centre for Disease Control and Prevention on Friday confam di outbreak of Ebola for Democratic Republic of Congo.
Di top public health agency for Africa confam di outbreak of Ebola for DRC wit 246 suspected cases and 65 pipo wey die for Mongwalu and Rwampara health zones, for Ituri province.
"Four pipo don die wey dem confam for laboratory. We still dey suspect some cases for Bunia, pending confirmation," di agency tok.
Di agency inside one statement say dem go hold sharp-sharp meeting wit Congo, Uganda, South Sudan and global partners to make sure say dem reinforce cross-border surveillance, preparedness and response efforts.
Di agency tok say dia findings suggest di presence of non-Zaire strain of di virus, and dem dey do more findings to further characterise am.
"Africa CDC dey worry about di risk of di virus to spread more becos of di urban context for Bunia and Rwampara, high population movement, and mining- related mobility for Mongwalu," di statement tok.
Ebola virus na serious disease wey fit kill pesin. E dey spread through direct contact wit di body fluids of pipo wey get am, contaminated materials or pesin wey don die from di disease.
Dis latest outbreak na afta five months wey Congo declare say Ebola outbreak don end afta dem record di death of 43 pipo.
Di new outbreak na di 17th wey don happun for di country since di disease start for Congo for 1976. Ebola outbreak wey don happun from 2018 to 2020 for east Congo don more dan 1,000 pipo.
Symptoms of Ebola virus and why e dey deadly

Wia dis foto come from, ZOOM DOSSO/AFP via Getty Images
Ebola na deadly virus wey im initial symptoms fit include sudden fever, serious weakness, muscle pain and sore throat.
Advance stages fit include vomiting, diarrhoea and - in some cases - both internal and external bleeding, wey dem dey call haemorrhaging.
Di incubation period fit last from two days to three weeks and Ebola fit dey associated wit oda sickness like malaria and typhoid.
Pipo dey catch am wen e get direct contact with dia skin wey get wound, mouth, nose, with blood, vomit, poo-poo or water from di body of pesin wey get Ebola.
Patients dey die from lack of water for dia body and multiple organ failure.
How you fit prevent Ebola virus

Wia dis foto come from, Luke Dray/Getty Images
Wash your hands evri time wit soap and water - Health pipo say make we wash hands wit soap and water and clean surfaces wit chlorinated water.
No dey touch pipo wey don dey infected - To prevent more of di infection, health professionals advise make pipo avoid contact wit pipo wey dey infected, including for dem to stop to shake hands.
Avoid deadi bodies
No dey kill, touch or chop bush meat
E get vaccine for di Zaire strain of Ebola, wey dey common for di past for Democratic Republic of Congo. And currently no approved vaccine dey for di Sudan strain of Ebola.
Howeva, early treatment of specific symptoms, fit improve survival of di pesin wey get am.
For medical teams, dem must wear full Personal Protective Equipment, PPE, wen dem dey attend to cases to prevent infection. Deadi bodi dem, for any body bag, must dey buried by pipo wey dey wear proper PPE.









