Nasiru El-Rufai fit get bail?

    • Author, Abubakar Maccido
  • Read am in 3 mins

One Kaduna State High Court go give ruling on bail application wey former govnor of di state, Nasir El-Rufai, file.

Dem carry El-Rufai go court last week on amended nine-count charge wey border on alleged fraud and abuse of office, wey Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) file.

On Tuesday for Kaduna State High Court, Justice Darius Khobo, tell court say ruling for di defendant bail application no ready, say dem no fit finish to write di decision. So dem shift di case go Tuesday, 21 April 2026, to give di ruling.

Court order order say make di defendant remain for Commission custody until dem decide di bail application.

For anoda development, Federal High Court for Kaduna bin don grant bail to Mallam El-Rufai for 200 million naira ($148,000) and two sureties wey go bring di same amount.

Court tok say one of di sureties must dey Kaduna State and get property wey worth 200 million naira with verified CofO, while di second surety must be respected elder wey elders council certify.

Afta dem finish investigation, ICPC file 10-count charge against Mallam El-Rufai and Mr. Joel Adoga befor Honourable Justice Rilwan Aikawa of Federal High Court, Kaduna.

Di cases come from long investigation wey Commission do on im time as Govnor of Kaduna State from 2015 reach 2023, wey border on allegations of abuse of office, fraud, and money laundering.

Di charges relate to alleged conversion and possession of money wey come from corruption, plus money laundering offences wey go against di law under Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022, and oda laws.

Di prosecution allege say di defendant collect 289,826,998.12 ($215,000) as severance allowance wey pass im correct entitlement of 20,013,245 naira between 2020 and 2023.

Dem claim say e collect $797,900 wey dem put for im domiciliary account wit Guaranty Trust Bank, from different pipo, and e sabi say di money na from illegal activities.

ICPC also allege say di defendant join bodi wit di second defendant, Mr. Joel Adoga, to hide wia $10,000 come from for July 2019.

Both defendants don deny di charges.

ICPC bin carry Mallam El-Rufai go Kaduna State High Court on amended 9-count charge on 13th April 2026.

Di charges border on abuse of office, fraud, plan to commit fraud, and giving unfair advantage, wey go against ICPC Act, Advance Fee Fraud and oda Related Offences Act, Kaduna State Penal Code, and Kaduna State Public Procurement Law.