Pope Leo XIV get lung cancer, Vatican tok

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Sarah Rainsford
- Role, Southern and Eastern Europe correspondent
- Reporting from, at the Gemelli Hospital, Rome
- Author, Olivia Ireland
- Published
- Read am in 5 mins
Doctors don diagnose Pope Leo XIV wit lung cancer, but dem successful carry out di surgery to remove one lower lobe from im right lung, di Vatican tok for one medical bulletin.
Di 71-year-old bin undergo one 90 minute surgery on Tuesday for Rome Gemelli Hospital and dem later diagnose am wit lung adenocarcinoma.
"Afta di operation, di Pope wake up normally and return afta one brief period of observation to im room on di10th floor," di Vatican tok for statement.
Dem first detect di lump during wetin di Vatican describe as "routine checks".
Earlier, large crowds gada outside di hospital to greet di Pope, as some bin wait for several hours.
Dem shout dia greetings and well wishes as e pass by, while e wave and smile back through di lowered back window of im car.
Im staff meet am on di hospital steps. "I dey sorry," one of dem show sympathy, di Pope smile give and nod. "We dey hia for you," dem assure am.
For dia statement, di Vatican tok say dem remove di whole lower lobe of di Pope right lung "to ensure di procedure dey radical".
End of Di one wey oda users dey read well well
One Vatican source tell Agence France-Presse news agency say dem don carry out further tests to see if any sign dey to know if di cancer don spread.
Na Leo XIV imsef announce di tori of im operation give di world on Sunday, as e dey tok from di balcony for St Peter's Square afta e deliver di traditional Angelus blessing.
E say doctors don "contain" di nodule, or growth, wey dey im lung as dem find am "at a very early stage", but doctors advise am to remove am.
Gemelli thoracic surgery team bin operate on do Pope. Di team bin don already clear dia schedule until 20 October to give am time to recover.
Nodules dey quite common and no necessarily dey cancerous, but afta dem examine am, di medical team confam say na pulmonary adenocarcinoma, "as suspected by pre-operative tests", di Vatican tok.
Di Vatican don stress am say di pontiff, wey pipo generally believe say dey fit, no show symptoms of infection or illness.

Wia dis foto come from, Getty Images
Cardinal Kikuchi Tarcisio Isao of Tokyo bin write on social media say im meet wit di Pope Leo on Monday, and e say di pontiff no feel "anytin wrong" physically.
E say di Pope bin decide to check in for surgery as soon as possible becos e suppose travel go Latin America for early November, and e dey hope to stick to di plan.
Di trip particularly dey important becos e include one visit to Peru, wia di pontiff bin serve as missionary and den as Bishop for many years.
Despite all di reassurances, di tori don shake all Catholics all ova di world.
"Am I worried? Yes, becos I really no dey expect anytin like dis," Vatican Secretary of State Cardinal Parolin tell tori pipo on Tuesday.
E say di news be like "bolt from di blue", but e say di cardinals dey shocked by di Pope "calmness" and dem dey confident say im go recover.
Outside Gemelli Hospital, wey don treat several popes and be home to one large statue of John Paul II, few Catholics remain for there afta dem admit di pontiff.
Carla don come specially, wanting to be close.
"E look so calm, so we dey calm too - even though sickness always na bad tin," she tell BBC. "We go wait hia and pray."
Wetin be adenocarcinoma of di lung?
According to Harvard University, Adenocarcinoma of di lung na type of non-small cell lung cancer. E dey occur wen abnormal lung cells multiply out of control and turn to tumour.
Eventually, tumor cells fit spread (metastasize) to oda parts of di body wey include di lymph nodes around and between di lungs, liver, bones, adrenal glands and di brain.
Adenocarcinoma na di most common form of lung cancer. Dem dey generally discover am for pipo wey dey smoke.
However, na di most common type of lung cancer for nonsmokers. Na also di most common form of lung cancer for women and pipo wey dey younger dan 45.
Compared to oda types of lung cancer, medical pipo fit manage adenocarcinoma for one area. If e dey truly localized, e fit respond to treatment beta dan oda lung cancers.
Di risk of adenocarcinoma fit increases if pesin dey:
- Smoke. Smoking cigarettes na by far di leading risk factor for lung cancer. Cigar and pipe smoking dey very likely to cause lung cancer as cigarette smoking.
- Breathe tobacco smoke. Pipo wey no dey smoke wey inhale fumes from cigarette, cigar, and pipe smoking get increased risk of lung cancer.
- Exposure to radon gas. Radon na one colorless, odorless, radioactive gas wey dey form for ground. E dey inside lower floors of homes and oda buildings and fit contaminate drinking water. Radon exposure na di second leading cause of lung cancer in nonsmokers. For smokers, radon exposure go ginger di already high cancer risk even more.

























