Ghana authorities relocate citizen wey face harassment for South Africa, prepare to remove odas as anti-immigration protest continue

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY
Ghana authorities say dem dey invite citizens for South Africa wey dey fear for dia lives to step forward make dem evacuate dem to di kontri.
Dis be afta series of anti-immigration protests for parts of di kontri wey begin last month.
Some South Africans dey demonstrate to demand say make foreigners and oda African migrants wey dey dia kontri comot and go dia own kontris.
According to di groups wey dey protest, foreigners dey take dia jobs, some dey involve for crime and odas dey stay for di kontri without legal documents.
On Tuesday 5 May, Ghana authorities relocate one man inside viral video wey bin show how some anti-foreigners campaigners dey harass am as im dey im shop dey work.
Inside di video, dem ask am for im immigration documents and oda tins wey give am permission to dey operate shop for di kontri.
Di group harass di man – Emmanuel Akowuah Asamoah wey dem tell am say make e comot dia kontri and "go back to fix im kontri."
Dem later force am to close im shop wey dem harass oda foreigners.
End of Di one wey oda users dey read well well
Inside oda videos, di group allegedly storm one hospital wey dem ask all foreigners to comot.
Dem also warn hospital staff say make dem ensure say all foreigners comot di public health facility to private clinic to get medical care.

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY
Victim of harassment speak bifor govment relocate am to Ghana
Ghana high commissioner to South Africa Benjamin Quashie meet wit di victim for harassment inside di viral video for 23 April wen im promise to offer consular services ahead of di relocation to Ghana.
Emmanuel Akowuah Asamoah tok at di time say make im family back home dey calm as di high commission and oda authorities dey deal wit di mata.
"I dey okay now, I dey fine. I wan tok say make my mama and oda relatives dey calm. Dem bin dey worried afta dem see di viral videos," im tok during di meeting wit di high commissioner.
Di commissioner tok say South African authorities don assure dem say dem go deal wit di issue even though protests dey continue for Pretoria, Durban, Mthatha and oda places.
Im also confam say di immigration process for di victim during di relocation bin dey smooth.
"As we bin dey return, di South Africa authorities ensure say im pass through immigration smooth and safe wey dem also apologize to am about wetin hapun and di harassment."
Ghana Foreign Minister Samuel Okudzeto Ablakwa say, "we dey happy to welcome our compatriot back home. I dey happy say di High Commissioner follow am return to di kontri."
Im add say "Ghanaians wey wish to relocate from South Africa to Ghana need to contact di High Commission make govment assist dem to return."
Samuel Ablakwa say di Ghana govment go bear di expenses for di relocation of di citizens wey wish to return home.
"We dey value every Ghanaian life anywia for di world wey we no go abandon our citizens wey dey distress," di foreign minister write on top im social media.
Ghana authorities say dem dey reunite di victim wit im family wia im go dey safe for now.
Emmanuel Akowuah Asamoah say im dey happy to return to im kontri, im tok say oda foreigners for South Africa dey face similar case of harassment for dia workplace and oda public places.

Wia dis foto come from, IHSAAN HAFFEJEE/ANADOLU VIA GETTY IMAGES
Govment go support oda Ghanaians for South Africa wey wan dey repatriated
Di Ghana High commission for South Africa bin dey meet some Ghanaian communities for di kontri.
For 28 April, oga Benjamin Quashie visit di Ghanaian community for East London wia im listen to dia concerns about di reported xenophobic attacks and oda cases of harassment and anti-immigrants protests wey bin dey happun for di kontri.
Im assure dem say di mission go make sure dey protect and support dia welfare.
Inside one interview wit local network TV3, di High Commissioner confam say im get reports of oda Ghanaians wey "face harassment and hostile treatment from some South Africans."
"We don receive oda reports and complaints wey we bin visit dis citizens to offer support. Dem bin beat some pipo wey some also face harassment every day from dis anti-immigrants protesters among odas."
Im add say "oda foreigners also dey face di same harassment but we hope say dis tin go stop make pipo live in peace and do dia legal business."
On di mata of di govment plan to relocate oda citizens wey wan comot for di kontri, oga Benjamin Quashie tok say, "di govment dey ready to assist anybody wey wan return home."
"Anybodi wey feel say dia life dey under threat or dem no feel safe wey dem wan comot di kontri fit contact di high commission make we begin di process, as di foreign minister don tok."

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY
Di High commission provide 24-hour hotlines wey dem also announce dia email address wey pipo fit use to contact dem.
Citizens go need to contact dem to register for repatriation as di commission begin to activate di plans.
Dem also ask citizens to report any incidents of suspected cases of attacks to di commission.
Presidents of both kontris don condemn di attacks and harassment of foreigners for South Africa since di fresh wave of anti-foreigners' protest begin.
Di UN Secretary-General Antonio Guterres don also condemn di attacks, oda African kontris dey demand action to deal wit dis incidents.
In fact, Nigeria also begin processes to repatriate dia citizens wey dey face similar threats and harassment.
At least 130 pipo bin register say make dem repatriate dem to Nigeria.
In di meantime, citizens wey dey stay for protest hotspots dey advised to stay indoors and close dia shops wen di demonstrations dey hapun.
Di High commission also dey warn dem to avoid public confrontation and exchange of words wit protesters.
Dem also advise say make pipo dey careful of content dem bin dey share online wey dey connected to dis protests and xenophobic attacks in general.











