Ghana vs England World Cup Group L match preview

Both teams have three points from their opening game

Wia dis foto come from, FRANCOIS NEL/KARL BRIDGEMAN VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di Three Lions and Black Stars bin dey face each oda after dia 2011 friendly game end 1-1 wit goals from Andy Caroll and Asamoah Gyan
Published
Read am in 6 mins

Di Black Stars of Ghana dey prepare to jam wit di Three Lions of England for dia second Group L match on Tuesday 23 June.

Both teams win dia first game wey each of dem get three points ahead of dis game.

Ghana beat Panama 1-0 wey England sama Croatia 4-2.

Di team wey go win dis game go automatically qualify for di R32 stage of di World Cup wey dey happun for di US, Canada and Mexico.

But di game no go dey easy as tension already dey bifor di match go even begin wit off-di-pitch issues wit Ghana midfielder Thomas Partey.

Afta im miss di first game wey dem play for Canada sake of dem deny am visa, di ex-Arsenal midfielder dey ready to play for dis game for di US.

Di two teams jam once for 2011 for friendly game wey end 1-1. Andy Caroll bin score bifor halftime for dat game bifor Ghana all-time highest goalscorer Asamoah Gyan bin equalize for di 90th minute.

15 years later, di two teams go jam each oda for di World Cup for di Boston Stadium wey di stakes dey high.

Pundits say dem expect England fans to create hostile atmosphere for Thomas Partey for dis game as im continue to face criminal charges for rape for di UK.

Di player bin deny all di allegations wey im plead not guilty for court, di trial go begin for June 2027.

But wit experience for dis kain tin, football fans get how dem dey treat players wey go make dem shake for di pitch when dem dey paly against dem.

Earlier Scotland fans bin boo Morocco captain Achraf Hakimi when dem meet for dia Group C game.

Morocco win dat game 1-0 but di Scottish fans bin boo every touch of di PSG and Morocco captain wey dey face rape charges.

Hakimi also bin deny di allegations wey one French court tok say dem go soon begin trial for im case.

Dat kain treatment dey expected for Thomas Partey if dem select am for dis game but sabi pipo say dem trust say di 33-year-old get di mental capacity to deal wit di hostile atmosphere.

Apart from dis mata, everytin dey set for di Black Stars to face di Three Lions of England.

Ghana and England played a 1-1 draw in 2011

Wia dis foto come from, GFA/EDDIE KEOGH/FIFA VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Both coaches dey respect diaserf; Queiroz say im go select team wit African DNA, Tuchel say im go stick to dia identity even as dem dey adapt

Wetin di coaches and key players tok

England Coach Thomas Tuchel say im dey aware of di strength of di Ghana team wey im go select team wey go compete wit dem.

"One of Ghana strength na di counter attacks, sake of Ghana dey play wit physicality, speed and individual quality."

Thomas Tuchel say "Ghana neva dey mind say dem no get too much of di ball, sake of dem fit hit you for di counter, dem also dey direct, dem neva dey shy to use long balls."

For di pre-match press conference di 52-year-old coach add say "na different approach dem dey use for dis game, dat na di beauty of di game, different cultures and different approach."

"We gatz adapt and use our own strength to meet di approach of our opponent and put in top performance if we want to win."

Di Three Lions coach get positive news as Arsenal winger Bukayo Saka dey recover from im injury scare.

"Saka no dey feel any more pain, im dey get beta wey im dey feel more free for im movement."

"Im train for di last two days for di highest level, na so im dey ready to go."

Arsenal midfielder Declan Rice say England gatz pick up from dia 4-2 win against Croatia when dem meet di black Stars of Ghana.

"We gatz build on top dat performance, also we don watch Ghana games wey we prepare for dem like we dey prepare for every team."

Rice add say "even though dem bin change dia coach, dem still get very good players so if we no play our own game for 100%, dem go punish us."

Ghana coach Carlos Queiroz tok journalists say im get gat just one objective – to find di way to win, to fight for di win.

"I dey confident say di team we go select for dis game go dey ready and motivated. Dat team go fight for di win, dem go be strong, dem go dey enthusiastic."

Di 73-year-old Portugues coach say football don change well well but di DNA of teams still dey.

"England gatz great team and coach wit big profiles but we go also play wit our own style and our DNA, dem get dia culture, we too we get our own."

Carlos Queiroz dey under pressure to deliver afta im take ova di Ghana job wit only two months to di tournament.

Im no also get enough time to train wit di squad but di gaffer say im dey trust im team well well.

"I want make my players enjoy diasef for dat game and dey true to di African football DNA just like di way di English team go also use dia own identity."

Ghana captain Jordan Ayew say di team go dey togeda to deliver di result for Ghana fans.

"We go make Ghana proud afta dis game, I fit promise you dat. We go work as one team and without di fans we no be anybody so e dey important say di fans go come support us."

Di ex-Crystal Palace striker tok say "di fans gatz continue to push us wey you go see di effect."

On im role as captain and leader for di team wit many young players, Jordan Ayew say "I dey try my best to guide di boys to make dem feel comfortable and take di pressure off dem so say dem fit deliver."

"I gatz perform, di boys also gatz perform, na teamwork."

Possible lineups

England XI: Pickford (GK); James, Konsa, Stones, O'Reilly; Rice, Anderson, Bellingham; Madueke, Kane, Rashford

Ghana XI: Asare; Adjetey, Mensah, Opoku, Senaya; Yirenkyi, Semenyo, Partey; Ayew, Sibo, Fatawu

Di game go happun for di Boston Stadium at 8 PM GMT (9 PM WAT).

Make you join us for commentary for dis game.