Cameroon end Morocco title race, Malawi beat Algeria to reach final

Wia dis foto come from, Cafonline
Di Indomitable Lionesses of Cameroon qualify for di final of di Women Africa Cup of Nations afta dem beat host kontri Morocco for di semi-final.
Morocco lose 1-3 on penalties to Cameroon afta dem play 0-0 for regulation time.
Cameroon goalkeeper Michaely Biniha become di hero of di match afta she save four penalties wey Morocco play for di match.
Morocco suffer anoda humiliating defeat for dia house in front of dia home fans as dem no qualify for di final dis time.
For di second semi-final, newcomers Malawai make history to qualify for di final for dia veri first appearance for Wafcon.
Dem beat Algeria 3-1 for di semi-final to progress to di final.
Malawi also enta di history book as dem become di seventh different nation to reach di final since di first tournament under di current format in 1998.
Malawi na di first Wafcon newcomers since Zimbabwe for 2000 to reach di finals.
Malawi na di only third first timers since 1998 wey don progress beyond di group stage, afta Zimbabwe in 2000 and Botswana in 2022.
Cameroon go now face first timers Malawi for di for di final of di Women Africa Cup of Nations wey go happun on Sunday 16 August, 2026 for di Moulay El- Hassan stadiuM, Rabat.
Morocco and Algeria go face each oda for di Olympic stadium, Rabat for di third olace match on di Saturday 15 August.
Road to Wafcon final
Cameroon and Malawi shock football fans for di 2026 Wafcon, many pipo no expect say dem go reach di final fot tournament wey get ogbonge kontris.
Kontris like Nigeria wey be record 10-time winners and defending champions, host kontri Morocco wey be last year finalists, Zambia wey bin win am for 2022, Ghana sef dey wey dey compete for di tornament back to back.
But like di popular saying, anytun fit happun for football inside untill referee nlow di final whistle.
Make we look as dis kotris take reach di 2026 Wafcon final.
Cameroon
Cameroon dey for Group D with Ghana, Mali and Cape Verde.
Cameroon beat Ghana 1-0 dem beat Mali 2-1 and play 1-1 against Cape Verde
Di Indomitable Lionesses top Group D wit seven points.
Dem jam Nigeria for di quarter-finals wia dem clear di doubt of Nigeria wey be defending champions and 10- time winners.
Nigeria also be one of di favourites for di tournament but Cameroon no let am happun.
Dem also remove host kontri afta dem beat dem 3-1 on penalties for di semi-final.
Malawi
Malawi dey for Group C wit Zambia, Egypt and Nigeria.
Malawi beat Nigeria 3-2 for dia opening match.
Dem beat Egypt 3-1 for dia second group game.
Dia only loss for di group stage na to Zambia wey beat dem 2-1
Malawi finish as Group C winners wit six points while Nigeria finish second for di group.
For di quarter-finals Malawi come from behind to beat Ghana 2-1
Di kontri wey come Wafcon for di first time beat Algeria 3-1 for di semi-final to progress to dia first eva final.









