Why Dangote dey sell shares of im refinery and how e go benefit Nigerians?

Wia dis foto come from, Channels TV/Website
Africa richest man, Aliko Dangote don announce say in di next few days, e go start to dey sell shares for im refinery.
Di President of Dangote Group, Alhaji Aliko Dangote, tok for di signing ceremony say e wan use di money from dis offer to take carry di refinery from im present level of capacity go higher one.
E also tok say e want make di pipo wey no too hold money like dat to fit be shareholders of di refineries.
Dis wan show for di minimum amount of shares wey e say pipo fit buy from di ofer wey be 10.
Di initial public offerign go release 4.1 billion ordinary shares for markey at di rate of 525 naira ($0.40) per share and de expected to go lie for Monday, 14 September.
For statement, Dangote Group call dis IPO say na di biggest offering for Africa history as di offer dey target to make ova two trillion naira ($1.5 billion).
All dis one dey come as, petrol price don almost reach 1,400 naira as at di end of August.
Di mata bin dey bicos of say Dangote Petroleum Refinery increase gantry price.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dangote raise dia gantry price by 65 naira per litre on 29 August, from 1,200 to 1,265.
See ehn, according to Reuters no be only Nigeria dey torchlight di shares sef.
Last week Thursday, Dangote bin enta Botswana to tell dem about di planned IPO release.
Dangote Refinery dey for Ibeju-Lekki area of Lagos and e cover a land area of approximately 2,635 hectares.
According to di Dangote Group, di facility go be di world largest Single-Train 650,000 barrels per day Petroleum Refinery wit 900 KTPA Polypropylene plant.
At full capacity, e dey expected to meet 100% of Nigeria requirement of all refined products and e go get surplus for export.
E dey designed to process large variety of crudes including many of African Crudes, some of di Middle Eastern Crudes and di US Light Tight Oil.
E get 177 tanks of 4.742 billion litres capacity.
According to statement from Dangote, dem use di world largest dredgers to dredge 65 million cubic meters of sand and e cost approximately €300 million.
How dis one go help Nigerians
According to statement from Dangote, dis IPO dey target who dem call "ordinary Nigerians and Africans to hold shares".
Dis dey come afta for di beginning time wey Dangote Refinery start to dey run, e bin reduce prices.
Even sef Alhaji Dangote don tok am, as e say, "what we dey try to do na to make sure say, majority of all dis, our drivers, our cooks, our, youknow, servers, our managers, evribodi, dem go get opportunity to get stake for dis refinery."
Di day IPOs start to dey trade, e mean say investors fit now buy enta companies wey bifor na private investors get dem.
Di benefits of IPOs for pipo wey buy na high returns on investment, more liquidity and lower risk wen you compare am to oda investment opportunities.
But e also get risk of regulatory uncertainties and wetin fit happun afta change of management styles.
According to Nigeria Bureau of Public Enterprises, di sale of shares for IPOs go dey limited per pesin or institution investor very so e go fit reach many pipo.













