Egypt 0-1 Uruguay: Five things wey happen for Ekaterinburg

Egypt v Uruguay
Published

Egypt lose dia first match for World Cup against Uruguay for Ekaterinburg.

Di match hard di Pharaohs as dem struggle to create chances.

Dis na di five things wey happen for Ekaterinburg

Jose Gimenez break Egypt heart

Uruguay player

Uruguay player Carlos Sanchez play free-kick from di right, na so Jose Gimenez jump pass two defenders to header inside di net for di 89th minute.

Star boy Mohammed Salah no start for di Pharaohs

Mo salah

Coach Hector Cuper put Salah for bench. Di striker never play since im wound im shoulder for Liverpool Champions League final defeat to Real Madrid for 26 May.

Plenty empty seat inside di stadium for Ekaterinburg

Empty seats

Di stadium no full at all as empty seats full every wia.

Suarez no see road score

Suarez

Di Barcelona striker no really worry Egypt defence, im loss well well for di match.

Egypt attack dey weak without Salah

Mo salah

Di Pharaohs attack dey very weak without dia star boy Mohammed Salah, na only three shots on target dem get for di match.