India 'cockroach' protesters call off strike as education minister Pradhan resign

Dharmendra Pradhan

Wia dis foto come from, Getty Images

Published
Read am in 1 mins

India Education Minister Dharmendra Pradhan don resign afta weeks of protests ova exam paper leaks and testing irregularities.

Di resignation follow weeks of demonstrations wey di Cockroach Janta Party (CJP), one collective wey start as satire bifor e expand into one big campaign for accountability and education reforms.

Pradhan bin announce im resignation on X for one post, just hours bifor di third round of toks between di govment and di Cockroach Janta Party (CJP).

Prime Minister Narendra Modi don accept Pradhan resignation earlier on Saturday. Di govment neva announce who go replace am as minister.

Protesters don continue to gada for Delhi Jantar Mantar – di main protest site – as many of dem dey celebrate wetin dem see as major victory.

What began as a student-led campaign against alleged exam paper leaks became one of India's biggest displays of public dissent in recent years, with thousands camping in Delhi and demonstrations spreading across the country.

Wetin be di Cockroach Janta Party?

Di CJP bin start as one of India biggest youth protest movements, even though e no be political party.

Dem form di group afta di chief justice of India compare some unemployed young pipo to "cockroaches".

E later say im bin dey refer to pipo wey get "fake and bogus degrees", but by then, di term don get a life on its own.

Many young pipo wey dey frustrated by rising unemployment and irregularities for competitive exams - embrace am, dem turn di insect into one symbol of defiance and resilience.